‘Bee-keeping dey lucrative and no actual start-up cost’

Wetin we call dis Video,
‘Bee-keeping dey lucrative and no actual start-up cost’
    • Author, Tunde Ososanya
    • Role, Senior Journalist, BBC News Pidgin
    • Reporting from, Ibadan, Oyo State

Twenty-seven-year-old Fauzziyah Isiak and oda Nigerian bee-keepers dey try boost local production of honey as billions of dollars na im di kontri dey spend on di importation of dis product.

Fauzziya tell BBC News Pidgin say di business dey lucrative and pipo fit start wit capital wey dem fit afford.

Di young bee-keeper also debunk some of di myths wey dey associated wit bees including stinging.

"Na true say if bee sting pesin, di pesin fit take dia die, but no be evribodi fit die from bee sting.

"Some bees dey wey be say you fit naked go wia dem dey live, make dem even dey your bodi like dis," Fauzziyah tok.

Filmed by Olawale Adekola