Who dey incharge of Chelsea afta Enzo Maresca comot

Maresca holding im mouth, McFarlane for left looking straight

Wia dis foto come from, Getty Images/Chelsea FC

Read am in 5 mins

Chelsea Under-21s head coach Calum McFarlane go take charge of Sunday Premier League match wit Manchester City, as di club dey work to appoint who go be Enzo Maresca successor.

McFarlane na former coaching staff for Manchester City academy - and na im go take Friday press conference.

Maresca and im coaching staff comot for Chelsea on New Year's Day and Strasbourg manager Liam Rosenior be like di leading contender for di job.

Meanwhile, McFarlane go dey incharge of Chelsea for di little time, but e neva take charge of senior professional football match bifor.

McFarle dey for first season as Chelsea academy coach, afta e join from Southampton for summer, and e don lead di under-21 team to fourth position for di Premier League 2 afta nine matches.

McFarlane join Chelsea afta two years in charge of Southampton Under-21s.

E cross paths withChelsea academy technical director Glenn van de Kraan wey dey appointed from Man City for 2024.

McFarlane get impressive start for Chelsea, as e guide im side to first place for di league phase of di Uefa Youth League wit wins ova Barcelona, Benfica, Bayern Munich and Ajax.

Afta di game on Sunday, e possible make Chelsea don get new coach, but who be di contenders?

Who be di contenders for Chelsea coaching job

  • Liam Rosenior (Strasbourg)
  • Roberto de Zerbi (Marseille)
  • Kieran McKenna (Ipswich)
  • Francesco Farioli (FC Porto)
  • Frank Lampard (Coventry)

Why Enzo Maresca comot Chelsea

Enzo Maresca

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Chelsea win only one of dia last seven league matches under Enzo Maresca

Enzo Maresca bin comot from im role as Chelsea manager as di club dey fifth for di English Premier League table.

Di 45-year old Italian pack im property leave Stamford Bridge just less dan six months afta e win di Club World Cup for di end of im first season in charge.

Chelsea management tok for dia statement on Thursday say: "Enzo and di club believe say change go give di team di best chance of getting di season back on track."

Di Blues don win only one of dia last seven league matches and take only six points from six games for December as dem fall 15 points behind leaders Arsenal.

But match results na only small part of di tori.

Maresca, wey im contract suppose last till 2029, bin totori di ogas dem for Stamford Bridge - including sporting directors Paul Winstanley and Laurence Stewart, and dia co-owner Behdad Eghbali - as e carry Chelsea to finish for top-four last season and also win di Uefa Conference League and Club World Cup.

Howeva, success turn to sourness for im relationship wit di hierarchy.

Afta winning 2-0 against Everton 2-0 for dia single win for di Premier League for December, Maresca shock many pipo wen e tok say "many pipo" don make am di "worst 48 hours" since e join di club.

Dose comments bin come witout any warning to club staff or senior management, who for prefer make di mata remain private.

But wahala don dey shele for months bifor dat.

Maresca bi get hope say e go fit raise im profile afta di Blues successes tru opportunities outside di club. E bin plan to publish book bifor dem block am, and e speak for di Il Festival dello Sport - one event for Italy organised by La Gazzetta dello Sport newspaper - witout di club permission.

E also make public say e disagree wit di club as dem no sign central defender afta Levi Colwill bin injure im anterior cruciate ligament for pre-season. Di club hierarchy explain say if dem do dat, e fit make dia academy prospect Josh Acheampong to request for transfer, and Maresca later back down.

Di former Leicester manager has bin also change agents - from di Wasserman agency to Jorge Mendes - and im name bin don come up as potential successor to Pep Guardiola for Manchester City, which Maresca bin dismiss.

Also, e don dey avoided wearing club tracksuits - instead choosing to wear im own clothing.

Afta im last game wit Chelsea - di 2-2 draw wit Bournemouth for 30 December - assistant manager Willy Caballero said Maresca bin no feel well to do im post-match media duties, but tori be say im absence na more due to say e don dey tire wit di club.

And e dey even more noticeable wen Chelsea bin post one 52-second video for social media for New Year Eve to summarise dia year, Maresca bin no dey di video.

Di Italian believe say di pressure for im dey unfair sake of wetin e feel say na difficult working conditions, and say di management bin cross line in terms of attempts to influence im team selection.

Although e tok say e no dey vex say e dey manage young squad, e feel say di supporters expectations suppose dey managed regarding wetin dey achievable - especially sake of injuries to Colwill and attacker Cole Palmer.

Chelsea bin plan to assess Maresca position for di end of di season if results improve, but Maresca no longer dey happy and dat na di main factor as dem agree to go dia separate ways.

Di Blues next match na against second-placed Manchester City on Sunday - starting a difficult month wey also includes matches against Arsenal and Napoli.