40 pipo die, 119 injure for di Swiss Ski resort fire and most of dem na teenagers
Fire outbreak for one Swiss ski resort don don kill more dan 40 pipo and injure anoda 119, officials tok.
Di bar, Le Constellation for di resort of Crans-Montana, bin dey full of Swiss pipo and tourists wey bin dey celebrate New Year Day for di early hours of Thursday wen di fire start for di basement area.
Prosecutors tok say, according to initial investigations, na sparklers on champagne bottles wey dem carry too close to di ceiling go likely cause di fire.
Switzerland President Guy Parmelin call am "one of di worst tragedies" wey di kontri don ever experience.
One teenage golfer from Italy na di first victim di media name, though not officially.
Families of missing teenagers dey face agonising wait for information, as dem neva identify most of di 40 victims and six of dos wey injure.
Italian golfer Emanuele Galeppini feared dead
Several media outlets don name 17-year-old Italian golfer Emanuele Galeppini, as di first identified victim of di fire afta one statement from di Italian Golf Federation.
One tok-tok pesin for di Italian foreign ministry tell BBC say dem neva confam am.
For inside one tribute, di Italian Golf Federation call Emanuele a "young athlete wey carry wit am passion and authentic values". But di statement no mention di fire in Switzerland.
Local Italian media bin initially report say Emanuele father tok say im son dey di bar on di night of di fire, and di family last contact with am na for midnight.
Police commander Frédéric Gisler confam on Friday say dem don formally identify 113 out of di 119 pipo wey injure.
Dos wey dem identify include:
- 71 Swiss citizens
- 14 French
- 11 Italian
- Four Serbs
- One Bosnian
- One Belgian
- One citizen from Luxembourg
- One Polish citizen
- One Portuguese
E warn say di figures fit change.
Many of dos wey injure for di fire still dey critical condition, authorities tok.
French football club FC Metz say one of dia youth players dey "severely burned" for di fire. Dem don airlift Tahirys Dos Santos, 19, go one hospital for Germany for treatment, dem add.

Wia dis foto come from, MAXIME SCHMID / AFP via Getty Images)
For one news conference on Thursday morning, police say "several dozen" pipo dey assumed to don die for di fire, although e too dey early to give a precise number.
Di Italian foreign ministry - wey cite Swiss police - tok say dem believe say around 40 pipo go don die.
Believe dey say several pipo don die and more dan 100 injure afta one fire break out for one ski resort for southern Switzerland, officials tok.
Police tok say several nationalities likely dey involved for di New Year Day fire, wey happun at 01:30 local time (00:30 GMT) for one bar dem call di Le Constellation for di resort of Crans-Montana.
Dem dey treat am as fire and "no question" dey of any attack, di region chief prosecutor tok.
Dem don set up one helpline for concerned families: +41 848 112 117
Hia na wetin we know so far.
Around 100 pipo don injure, majority of dem wit severe burns, Swiss officials tok. Dem don carry most of dem to Valais hospital wia di intensive care unit now dey full, according to local authorities.
Authorities don send ten helicopters, 40 ambulances and 150 emergency workers go di scene.
Work dey go on to identify di victims and return bodies to families as quickly as possible, di region chief-prosecutor Beatrice Pilloud tok.
Di Italian ambassador to Switzerland tok say e fit take weeks to identify di dead. Earlier, Italy foreign minister say identification go dey difficult sake of di severe burns.
Dem believe say pipo from several countries dey involved and French media bin report say at least two of di pipo wey injure na French nationals.
French President Emmanuel Macron don offer "di full solidarity of France and our fraternal support" to Switzerland.
UK embassy for Switzerland say dem dey monitor di situation but nobody don approach dem for assistance.
Consular staff dey on standby to support any British nationals wey dey affected, one Foreign Office statement tok.
Wetin cause di fire?
Béatrice Pilloud, di attorney-general of di Valais region, tok say evritin don lead investigators to believe say na sparklers wey attached to bottles of champagne cause di fire.
"Everything lead us to think say di fire start from sparkling candles - or sparklers – wey dem dey put on bottles of champagne and dem move am too close to di ceiling," she tell tori pipo on Friday. "From dat, di fire start very quickly."
BBC Verify don verify two fotos wey show lit sparklers attached to bottles inside di bar wey dey shared online wit claims say dem take am around di start of di fire, for 01:30 (00:30 GMT).
One foto show pipo dey hold several bottles for di air wit lit sparklers attached and wetin appear to be fire for di ceiling.
Di second foto show pesin wey wear sleeveless black dress and crash helmet dey hold bottle wit a lit sparkler attached, on di shoulders of pesin wey wear mask.
Wetin we know about Le Constellation bar?

Wia dis foto come from, Police Cantonale Valaisanne
Le Constellation na one large bar for di Swiss ski resort of Crans-Montana wey don dey around for many years.
Although di resort itself dey for popular area, Le Constellation particularly no dey posh, BBC Silvia Costeloe report from di resort.
For upstairs, one area wey get TV screens dey wia pipo dey go watch football matches. Downstairs get onebig bar wia pipodey likely go drink and dance.
E fit hold up to 300 pipo and e get one small terrace, although e neva dey clear how many pipo bin dey there at di time of di fire.
Di Christmas and New Year holidays na one of di busiest times of di year for Alpine ski resorts, and e dey likely di bar dey full of Swiss pipo and tourists wey dey celebrate di start of 2026.











