Tatiana Schlossberg, granddaughter of John F Kennedy, die at di age 35

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Kayla Epstein
- Read am in 4 mins
Tatiana Schlossberg, di granddaughter of former US President John F Kennedy, don die at di age of 35.
Her family announce her death for one social media post wey di John F Kennedy Library Foundation share: "Our beautiful Tatiana pass away dis morning. She go always dey our hearts."
For November, Schlossberg, wey be climate journalist, bin announce say she get aggressive form of cancer.
She bin tok am for one essay say dem give her less dan one year to live.
Schlossberg na di daughter of designer Edwin Schlossberg and diplomat Caroline Kennedy, and she dey survived by her husband George Moran and dia two children, three-year-old Edwin and one-year-old Josephine.
For one article dem publish last month for di New Yorker titled, "A Battle Wit My Blood," Schlossberg reveal say dem diagnose her wit acute myeloid leukaemia for May 2024, afta she born her second child.
"My first thought na my kids, children wey dia faces dey live permanently for inside my eyelids, no go remember me," she write.
Schlossberg describe di treatments she don receive, wey include chemotherapy and one bone marrow transplant, but tok say doctors no give her a good prognosis.
She bin also write of di pain she fear say her passing go cause for her family, wey don endure multiple personal tragedies.
Dem assassinate her grandfather, President Kennedy, for 1963 and her uncle, John F Kennedy Jr, die for inside plane crash for 1999.
Her younger brother, Jack Schlossberg, dey run for Congress for New York.
"For my whole life, I don try to be good, to be good student and a good sister and a good daughter, and to protect my mother and no ever make her upset or angry," Schlossberg write.
"Now I don add new tragedy to her life, to our family life, and notin wey I fit do to stop am," she tok.
For her essay, Schlossberg also express disappointment for her relative Robert F Kennedy Jr appointment to lead di Department of Health and Human Services.
One relative, Maria Shriver, wey be journalist and di former first lady of California, don pay tribute to her "sweet, beloved Tatiana" as pesin wey "love her life".
"She bin create beautiful life wit her extraordinary husband George, and children Eddie and Josie. She fight like a warrior. She dey valiant, strong, courageous."
"Tatiana na great journalist, and she use her words to educate odas about di earth and how to save am", Shriver write on Instagram.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Bifor her widely-read essay about her diagnosis, Schlossberg bin get successful career as a climate journalist.
Schlossberg na di author of di book "Inconspicuous Consumption: The Environmental Impact You Don't Know You Have". She also write about climate and oda beats for di New York Times.
For December 2021, she bin report on local experiments to harness di energy of di London Underground to provide heat to homes, as effort to fight climate change.
"I tink climate change na di biggest story for di world, and na story about everything," she tell NBC News for 2019. "Na about science and nature, but also na about politics and health and business. To me, as I dey look am like journalist, e dey feel like a really important story to tell."
"And if I fit help communicate about am, dat fit inspire oda pipo to get involved and work on di issue," she tok.









