Nollywood mourn actress Princess Allwell Ademola wey die at 49

Wia dis foto come from, Princess Allwell Ademola/Faceook
Di death of Princess Allwell Eniobanke Ademola, one popular Nigerian actress and feem producer don throw di Nollywood industry into mourning.
On Saturday evening, tori break say di 49-year-old actress don pass on, and di report leave her colleagues and fans in rude shock.
Di family of Princess Allwell Ademola wey announce her death, say dem go communicate details of her burial in due course.
For one statement, wey Adegboyega Adebayo sign on behalf of her family to announce her passing, say she die on Saturday, 27 December at di age of 49.
"Wit heavy hearts and total submission to di will of God, we announce di passing of our beloved sister, mother and aunt Princess Allwell Ademola wey comot dis world on Saturday, 27th of December at di age of 49," di statement read.
Di cause of her death no dey known, but tori wey dey spread wey BBC neva fit confam be say she suffer heart attack.
Tributes don dey pour in for di actress wey enta limelight for her role for one 2018 movie "Ile Wa".
President of Theatre Arts and Movie Practitioners Association of Nigeria (Tampan) Bolaji Amusan wey pipo sabi as Mr Latin also confam di tori of her death for one post on im official Instagram account.
"My heart dey heavy tonight. We don lost @allwellademola - a brilliant producer, director, and musician wey im passion, creativity, and spirit don leave deep mark on evrione wey sabi her. You come, you create, you inspire. Rest in perfect peace, Allwell. You no go eva dey forgotten," Oga Latin post read.
Her cousin wey also be feem actor and producer Muyiwa Ademola also confam her death wit heart-breaking emojis. "Na one of di saddest news I don eva get!" e tok as e wish her goodnight.
Her death come few hours afta she post one video on her Instagram account wey she take declare wit song say, 'I go see di end of dis year, dis year no go eva see my end".
Plenti of her colleagues and fans don enta social media to pen dia tributes to di actress wey many of dem describe as pesin wey dey calm, passionate about her work and industrious.
For many, tori of her death still be like dream, as dem say she dey healthy, she no sick and she bin jolly wit some of dem during Christmas.
Ogbonge actors like Femi Adebayo, Dayo Amusa, Iyabo Ojo and many odas express dia sadness, pain and shock to di loss.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 2
Who be Princess Allwell Ademola?
Princess Allwell Eniobanke Ademola na ogonge actress, movie producer and singer, but she like make pipo dey address her as entertainer.
According to her bio for her Instagram account, she add say she be brand influencer and CEO of Allwell&Co band.
Dem born her for 1976 into one royal family for Abeokuta, Ogun State, southwest Nigeria. She be di great grand daughter of di Alake of Egba land.
For one interview wit Tribune Newspaper, late Ms Ademola say she begin dey act feems wen she dey small, but her father no support her acting, so she stop am and start to sing wey her father support. Along di line, she enta stage productions becos of school and she start to dey do stage productions. However, she join Nollywood proper for 1992 and don act and produce plenti ogonge feems wey include Omo Emi, You or I, among odas.
Ademola also na talented singer and form her own band, "Allwell and Company," for 2002. She release one album for 2006.
She don win several awards, wey include Best Supporting Actress for di 2016 Best of Nollywood Awards for her role for "Hakunde".
Ms Ademola bin dey engaged and dey plan her wedding, but her fiancé die two months bifor dia wedding, and she remain single since den. For one interview wey she do, she say she bin dey follow her fiancé tok for phone, wia she hear di gunshot wey kill am. She say di tin shake her for years and make her depressed.









