Who be Ooni ex-wife Queen Zaynab wey marry SGF George Akume

Queen Zaynab

Wia dis foto come from, Queen Zaynab/Facebook

Read am in 3 mins

Congratulatory messages don begin fly around afta news comot say Queen Zaynab, di ex-wife of di Ooni of Ife Oba Adeyeye Ogunwusi don marry Secretary to di Govment of di Federation George Akume.

Pictures of di wedding don also go viral on social media and di pipo of Benue State don welcome dia new bride to di food basket of di nation.

Di Dajoh family wey Akume belong to confam di wedding for one statement wia dem describe di union as "beautiful".

"We di entire Dajoh Family, happily join our daddy, uncle and brother, His Excellency, Di Secretary To Di Govment Of Di Federation, Sen George Akume Jugu Dajoh in welcoming im new and uncommon wife, Queen Zaynab Ngohemba-George Akume Dajoh into di Dajoh family.

"We appreciate and tank di fans and supporters of Sen Akume for always standing by im. We enjoin evri one of you to continue to support his Excellency even for dis beautiful union wit Queen Zaynab. We wish you all a happy Christmas Celebration and a Prosperous New Year," di statement read.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Who be Queen Zaynab?

According to her website, Queen Zaynab na globally recognised philanthropist and humanitarian wey don use her profile and position to raise awareness of important issues such as poverty, education, and environmental sustainability both domestically and around di world.

Dem born her for Nigeria, and she don work wit United Nations and various charities and foundations across di world.

For 2017, she confam inside one post on her Instagram handle say her 17 months marriage to di Ooni of Ife don officially end but she no give reasons for di breakup.

"Wetin I fit confam be say di Ooni and I are no dey togeda again. I inhale love and exhale gratitude. My journey continue as humanitarian aiding women and victims of domestic violence and abuse wit di United Nations.

"No mata how much time you don invest, no mata di use of media to silence and manipulate, no mata di circumstance, slander, embarrassment, threats and lies: Get out and seek immediate help!" part of di statement tok.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Who be George Akume?

Dem born George Akume for December 1953, and na di current and 21st Secretary to di Govment of di Federation (SGF).

E bin serve as di govnor of Benue State from May 1999 to May 2007.

Akume bin also serve as minister of Special Duties and Inter-Govmental Affairs under President Muhammadu Buhari from 2019 to 2023.

E bin represent Benue North-West Senatorial District from 2007 to 2019. E bin occupy di position of chairman Senate Committee on Army.

Akume na also di Minority Leader of di Senate from June 2011 to June 2015.

On 2 June 2023, President Bola Tinubu appoint am as SGF.

Akume get Bachelor's Degree in Sociology and Master's Degree in Labour Relations from di University of Ibadan.

Di SGF also dey married to Regina Akume, wey be member of di House of Representatives.