Queen Naomi divorce Ooni of Ife? Adeyeye Enitan Ogunwusi and di women we sabi for im life

Wia dis foto come from, OONI OF IFE
Queen Naomi divorce Ooni of Ife? Na kwesion wey many Nigerians dey seek ansas to.
Dis be afta Queen Evangelist Silekunola Moronke Naomi Ogunwusi latest announcement.
Queen Silekunola Moronke Naomi announce wetin sound like separation from di Ooni of Ife, Oba Adeyeye Eni-tan Ogunwusi on Thursday, 23 December, 2021.
So for Nigeria now, tori of how di wife of di most respected king for Yoruba land explain for statement say she no wan be Queen again dey raise latest tok-tok.
From di days of King Solomon of olden days e dey common to hear say Kings fit marry more than one wife but na how di royals dey maintain be di usual concern.
Olori Naomi and Ooni of Ife don marry for three years, however e get oda women wey dey di Ooni life.
In fact, Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi II first wife afta e become Ooni of Ife separate from am just one year afta di marriage.
Di Ooni of Ife, Alayeluwa, Arole Oodua Olofin Adimula, Ooni Adeyeye Eni-tan Babatunde Ogunwusi na foremost traditional ruler for Yoruba kingdom.
End of Di one wey oda users dey read well well
Queen Naomi divorce Ooni of Ife?
For inside one long statement, Silekunola Moronke Naomi post on her verified Instagram page, she write say;
"Today I announce di beginning of a new dawn and di close of a chapter. Today, be mother to God unique gift. I, at dis moment, announce say I shall no longer be referred to as wife to di Ooni of Ife or as Queen of Ile-Ife but as di Queen of di pipo and mama of my adorable Prince…"
She add join say di Majesty get foto e like make world pipo see and how e want make dem see am as plus anoda one wey be im true sef.
She also say she try her best to endure and make di marriage work.
Dis no go be di first time, di Ooni of Ife dey experience failed marriage.
Ooni Ogunwusi II marriage to Queen Wuraola Zynab Ogunwusi
Oba Adeyeye Ogunwusi marriage to Queen Wuraola Zynab Ogunwusi, di woman e marry afta e become di traditional and spiritual leader of Ife, bin scata afta one year.
Tori be say di two divorce and go dia separate ways.
Queen Wuraola Zynab Ogunwusi na Bini Princess
Dem marry on March 12, 2016 and di Queen collect di title Yeyeluwa.
On August 2017, Her Highness Zaynab Otiti Obanor bin issue statement on her verified Instagram account wey confam di end of her marriage to di king.
She write say "Wetin I fit confam na say di Ooni and I no dey together again. I inhale love and exhale gratitude. No mata how much time you don invest, no matter di use of media to silence & manipulate, no matter di circumstance, slander, embarrassment, threats and lies: Get out and seek immediate help!
E no tey afta di marriage end, di Ooni find love again in di pesin of Prophetess Noami Silekunola.
Dem marry on October 17 2018. Di marriage produce one son, Prince Tadenikawo wey im birth dey well celebrated.
Announcement to dia separation come as shock as many pipo reason dis marriage na one wey go last well-well because of di love and affection wey di couple show.
Di Olori wey also enta social media to announce dia separation say " Make e dey known say dis decision to move on no come because im majesty dey married to another queen. As many go love to assume, throughout our life as a couple, I be di only married wife to am. Side attractions dey but e never be issue.
E get anoda woman, Omolara Olatunbosun wey born one child for Oba Adeyeye, Adeola Anuoluwapo for 1994 before e ascend di throne.
Queen Wuraola-Zynab Ogunwusi profile

Wia dis foto come from, ZAYNAB OTITI OBANOR
Queen Wuraola-Zynab Ogunwusi na former wife of di Nigerian monarch.
She bin go back to her maiden name Zaynab Otiti Obanor afta her marriage to Oba Adeyeye crash for 2017.
Na for March 2016, Zaynab marry Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi. For 2017, she file for divorce and di divorce dey finalized on August, 2017.
Zaynab dey born and raised for ancient royal bronze casters lineage tribe for ancient Benin Kingdom.
She dey known for her philanthropic works. She dey work as ambassador of the United Nations Population Fund (UNFPA), wey dey known for promoting women and children rights, health and equity.
Queen Silekunola Moronke Naomi profile

Wia dis foto come from, OLORI SILEKUNOLA
Olori Silekunola Naomi na di wife of Ife, Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi Ojaja II.
Di couple bin marry for 2018 and dem get one child togeda wey dem name Tadenikawo.
She come from Akure, di capital of Ondo State.
As Evangelist Naomi don declare say she no longer be Ooni queen, dis one mean say di king gas find anoda queen for imsef sake of say di position no fit dey vacant.
Di Evangelist wey add Prophetess to her title also be di founder of En-Heralds wey be church for Akure, Ondo State for southwest Nigeria.
Some women don dey linked to di Ooni but none of dem dey officially confamed as wife by di palace.
Ooni of Ife daughter mama na Omolara Olatubosun

Wia dis foto come from, Instagram\ooniadimulaife
Ooni of Ife wey be one of di most powerful kings for Yorubaland, get im first child, Adeola Aanuoluwapo in 1994 with Omolara Olatubosun.
For di early 90's, di Ooni wey be teenager bin get intimate relationship wit Omolara Olatunbosun.
Di relationship lead to di birth of Princess Adeola Ogunwusi.
For October 18, 2021, wen di daughter turn 28, di Ooni enta social media to celebrate her.
E write how e born her wen he be just nineteen years old and how di journey be for am as a young teenage papa.
Di Ooni say na huge responsibility for am and im rely on faith and determination.
"Di journey wit my daughter Princess Adeola dey filled wit uncertainty as a young papa, notheless, I gude my heart wit all diligence and gird my loins for all di challenges." Di King write for im Instagram page.
E no tey afta di post, Princess Adeola mama, Omolara for inside interview e get wit The Punch Newspaper express displeasure wit di claim of di Ooni say na only him raise dia daughter.
Omolara say na only her single-handedly raise Adeola from childhood until she turn 10 years old.

Wia dis foto come from, Other
Ooni of Ife, Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi Ojaja II profile
Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi Ojaja II ascend di throne of Ile-Ife for 2015 afta dem select am from Giesi Ruling House.
Im predecessor na Oba Okunade Sijuwade wey die on July 28, 2015.
One of di things wey di monarch dey known for na philanthropy. Everybodi know say im dey committed to di people wey no get.
Yoruba na Nigeria second biggest ethnic group. And di Ooni na di most respected King of Yorubaland.
Yorubaland no dey only for south-west Nigeria, e spread reach Togo and Benin.















