Wetin di US airstrike for Nigeria achieve?

Wia dis foto come from, Photo by Anna Moneymaker/Getty Images
Months afta US President Donald Trump bin threaten possible military action for Nigeria as e accuse di Nigerian govment say dem allow di killing of Christians, di US say dem launch "powerful and deadly strike" against di Islamic State for di kontri north-western geopolitical zone on 25 December.
For post ontop im Truth Social account, Trump say: "under my direction as Commander in Chief, di United States launch a powerful and deadly strike against ISIS terrorist Scum for northwest Nigeria, wey don dey target and viciously kill primarily, Innocent Christians at levels wey dem never see for may years".
Di US military say camps wey Iswap dey operate for Sokoto State, near Nigeria border with Niger, bin dey targeted. Dem add say "initial assessment" suggest "multiple" fatalities.
Nigeria Foreign Minister, Yusuf Maitama Tuggar, tell di BBC say di operation na "joint operation" and add say e get "notin to do wit a particular religion".
Critics don call out di govment say dem suppose inform Nigerians ahead of di action.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Wetin di airstrikes achieve?
Tangaza local goverment area of Sokoto State
Authorities for Tangaza local govment area of Sokoto State, north-western Nigeria, don confam to di BBC say di US airstrikes hit di Lakurawa militant camps.
Di chairman of di local govment area, Isa Salihu Bashir, say di strikes "hit some Lakurawa terrorists camps".
E say many of di fighters die but e no fit confam di number of pipo wey kpai.
Bashir also tell di BBC say Nigerian police and military personnel don dey unable to access di affected areas becos of raging fire wey follow di strikes.
Sokoto State shares border wit Niger Republic. E say di border patrols on di Niger side report say dem see Lakurawa fighter dey run comot for di area wey airstrike hit.
Lakurawa na relatively new Islamist militant group wey don carry out attacks for parts of Sokoto and Kebbi states for north-western Nigeria, as well as across di border for Niger.
Jabo village, Sokoto
Eyewitness Umar Jabo tell di BBC say di airstrike wey hit Jabo take place on Christmas night and evribodi bin tink say na plane crash.
"Evrione bin tink say na plane. E crash for fields."
Social media images show pipo wey dey stand for one field dey feem di burning aftermath of di attack.
Umar Jabo deny say di US kill any IS fighter "Here for Jabo, we live peacefully, and conflict no dey between us and Christians."
Offa, Kwara State
Di airstrikes also hit Offa for Kwara State, northcentral Nigeria.
Tajudeen Alabi, wey be former Special Assistant to Kwara State govnor on security matas confam di incident to di BBC.
Alabi say dem hear sound three times around 9pm on 25 December.
Di former Special Assistant say di strike hit and destroy buildings for several locations but as of now dem neva report any casualty but some pipo sustain injuries.
"At least, na about five structures destroy for different locations. We see some items for one popular hotel, we dey call am Offa Central Hotel. E be like bomb."
Fotos from di airstrikes





Wia Iswap dey operate for Nigeria
Di US airstrikes hit Sokoto state for north-western Nigeria, and claim say na Islamic State (IS) dem target. However, IS neva claim any attacks for Sokoto.
IS West Africa branch (Iswap) dey primarily active for north-eastern Nigeria (centred on Borno State). One separate branch of IS (Sahel Province) dey active mostly around di Mali-Niger-Burkina Faso border area, but don claim attacks for Dosso state for Niger (not far from di Nigeria border), including one veri recent sizable attack on di military.
For Sokoto and neighbouring Kebbi states, di militant Lakurawa group don increasingly dey active ova di past couple of years.
Speculation dey among analysts say IS fit don secure pledges of loyalty from Lakurawa so dem go fit establish demsefs for northwest Nigeria and neighbouring areas of Niger.
UN Security Council reporting don warn about IS expansion for dis regions.
For one indication say Sokoto go be likely US target, one pro-IS Telegram channel since (Mujrayat al-Ahdath) late November don dey offer approximately daily updates about flights of US "reconnaissance" planes ova northern Nigeria. Dis flights bin focus on Sokoto, as well as Iswap strongholds for Borno (wey fit suggest follow-up strikes for dis areas too).
Nigerians react to airstrikes
Many pipo don dey comment on di mata including opposition parties.
Di main opposition, di Peoples Democratic Party tok for inside statement wey dem drop on Friday say, dem dey concerned ova di way di information reach Nigerians .
Dem tok say, "di Federal govment suppose be di first to report di news to fit sensitise Nigerians instead to wait to confam tori wey don already dey outside, unless dem hear di informate like oda pipo".
Former presidential candidate Omoyele Sowore tok for statement say dis airstrike make "di kontri to dey reduced to bystander as dia sovereignty dey violated under di direction of US President Donald Trump".
E add say no be di work of Washington to protect Nigeria but beta leadership.
Meanwhile, Islamic cleric, Ahmad Gumi suggest say dis strike for Sokoto don turn Nigeria to theatre of war and tok say if na military assistance Nigeria bin dey find, dem for use China, Turkey or Pakistan.
Oga Gumi give im reason say, "Di US involvement for Nigeria go attract real anti-US forces and turn our land to theatre of war".
Dis na as e call on di govment to stop di military collabo wey dem get wit US and "find help wit di kontris wey we don tok".

Wia dis foto come from, Google Earth









