Wetin we know about di US airstrike wey hit Kwara State

US President Donald Trump bin launch "powerful and deadly strike" against di Islamic State for Nigeria but e also hit Offa area of Kwara State.
Tajudeen Alabi, wey be former Special Assistant to Kwara State govnor on security matas confam di incident to di BBC.
Alabi say dem hear sound three times around 9pm on 25 December.
Di former Special Assistant say di strike hit and destroy buildings for several locations but as of now dem neva report any casualty but some pipo sustain injuries.
"At least, na about five structures destroy for different locations. We see some items for one popular hotel, we dey call am Offa Central Hotel. E be like bomb."
"Around 1:30am, US President release statement say dem send airstrikes to northeast. To us, we believe say di drone miss di target and land for Offa. Bifor e land, I sure say e don weak, if not, we for don record some casualties. We tank God say na di structures dey affected.
"And dis morning, pipo dey dia to sympathise. Dem feem di damaged drones, some of di parts, you see am for di building wey collapse. Dat na wetin happun for Offa since yesterday night," Alabi tok.
Nigeria confam airstrikes on terrorist targets
Nigeria Ministry of Foreign Affairs wey also confam di strikes say dem collaborate wit America to carry am out.
For statement ontop dia X account, di ministry say Nigeria dey cooperate wit international partners including America to address di threat of terrorism and violent extremism.
Dem say di collabo lead to "precision hits on terrorist targets for Nigeria and by air strikes for di northwest."
"A total of 16 GPS-guided precision munitions nai we deploy using MQ-9 Reaper unmanned aerial platforms, e successfully neutralise di targeted ISIS elements wey dey attempt to penetrate Nigeria from di Sahel corridor.
During di course of di operation, remains from expended munitions fall for Jabo, Tambuwal Local Government Area of Sokoto State, and for Offa, Kwara State, near di premises of a hotel. No civilian casualties were recorded in either location, and relevant authorities promptly secure di affected areas."

Nigerians react to airstrikes
Many pipo don dey comment on di mata including opposition parties.
Di main opposition, di Peoples Democratic Party tok for inside statement wey dem drop on Friday say, dem dey concerned ova di way di information reach Nigerians .
Dem tok say, "di Federal govment suppose be di first to report di news to fit sensitise Nigerians instead to wait to confam tori wey don already dey outside, unless dem hear di informate like oda pipo".
Former presidential candidate Omoyele Sowore tok for statement say dis airstrike make "di kontri to dey reduced to bystander as dia sovereignty dey violated under di direction of US President Donald Trump".
E add say no be di work of Washington to protect Nigeria but beta leadership.
Meanwhile, Islamic cleric, Ahmad Gumi suggest say dis strike for Sokoto don turn Nigeria to theatre of war and tok say if na military assistance Nigeria bin dey find, dem for use China, Turkey or Pakistan.
Oga Gumi give im reason say, "Di US involvement for Nigeria go attract real anti-US forces and turn our land to theatre of war".
Dis na as e call on di govment to stop di military collabo wey dem get wit US and "find help wit di kontris wey we don tok".












