Christmas message from world leaders and how Christians celebrate around di globe

Wia dis foto come from, Getty Images
From skiing Santas for di US and Mass wit Pope Leo XIV for di Vatican, to giant cuts of meat wey dem dey throw to crowds for London, to Christmas jollof and chicken, plus gyration for Nigeria. Christmas celebrations around di world hapun in full swing.
World leaders drop messages of hope, peace and unity to encourage pipo for dis festive season.
Worshippers for Ukraine, China and Pakistan also gada for Christmas Eve services for dia local churches.
While most Christians dey mark Christmas on 25 December, many Orthodox Christians no dey celebrate until 7 January.
Dis na some of di messages from ogbonge leaders across di world plus best fotos of how di celebration dey jolly from around di world.
Pope Leo
Pope Leo urge Ukraine and Russia to find di "courage" to hold direct talks to end di war during im first Christmas remarks to crowds for St Peter's square.
E call for end to conflicts around di world during im Urbi et Orbi address, wey di pontiff traditionally dey deliver on Christmas Day to worshippers wey gada for Vatican City.
Speaking about Ukraine, di Pope say: "May di clamour of weapons cease, and may di parties involved, wit di support and commitment of di international community, find di courage to engage in sincere, direct and respectful dialogue."
Im message dey come as US-led negotiations on one deal to end di fighting continue.
During one earlier Christmas Day sermon for St Peter's Basilica, Pope Leo bin lament di conditions of homeless pipo all ova di world, and di damage wey conflicts cause.
"Fragile na di flesh of defenceless populations, affected by so many wars, ongoing or concluded, leaving behind rubble and open wounds," e tok.
E say di story of di birth of Jesus show say God "pitch im fragile tent" among di pipo of di world. "How, then," e ask, turning im attention to di conditions of Palestinians, "we no fit tink of di tents in Gaza, exposed for weeks to rain, wind and cold?"
Gaza dey devastated sake of Israeli bombardment for inside one a two-year war, wey di Hamas attack on Israel on 7 October 2023 trigger.
Bola Tinubu
Nigeria President Bola Tinubu renew im pledge to safeguard religious freedom across Nigeria, as e assure citizens say im administration stand gidigba to protect pipo of all faiths from violence and discrimination.
For im 2025 Christmas goodwill message, di President say im govment go continue to uphold di constitutional rights of Nigerians to live peacefully, practise dia faith freely.
E say no citizen suppose face persecution or hardship for expressing or practising dia religious beliefs.
Oga Tinubu add say im been meet wit leaders of Nigeria principal religious groups in response to growing concerns about intolerance and insecurity.
E say dem go strengthen dis engagements to deepen cooperation between di govment and faith-based institutions as way to prevent kasala and foster peaceful coexistence.
Donald Trump
US President Donald Trump Christmas message na banger. E hail all Americans plus pipo wey e refer to as "Radical Left Scum".
Di US leader also brag about im achievement since e return to office again for di Merry Christmas message e post on im social media.
"Merry Christmas to all, including di Radical Left Scum wey dey do evritin possible to destroy our Country, but dey fail badly. We no longer get Open Borders, Men in Women Sports, Transgender for Everyone, or Weak Law Enforcement. Wetin we get na Record Stock Market and 401K, Lowest Crime numbers in decades, No Inflation, and yesterday, a 4.3 GDP, two points dan expected."
E add say di tariffs wey e introduce wen e enta office back don give US trillions of dollars and strong national security.
Benjamin Netanyahu
Israel Prime Minister, Benjamin Netanyahu, condemn di persecution of Christians all ova di world, and e say di attacks on Christians for Nigeria must end.
Netanyahu make dis comment as part of im Christmas message wey e send from Jerusalem.
For one video e post on im X account, di Israeli PM hail all Christians across di globe as e condemn di global persecution of di Christian faith for middle eastern countries like Iraq, Syria, Lebanon, and Turkey.
"Di persecution of Christians or members of any religion cannot and must not be tolerated, and Muslim militant displacement and attacks against Christians in Nigeria, dat too must end, and it must end now," di Israeli PM tok."
Fotos of how Christians celebrate Christmas

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Reuters










