Christmas messages from leaders around di world

Collage of some world leaders

Wia dis foto come from, Getty Images/Akufo-Addo X

Wetin we call dis foto, Collage of some world leaders
Read am in 4 mins

As millions of pipo around di world dey celebrate Christmas day wit dia families and friends, leaders around di world don drop messages.

See some of di messages from ogbonge leaders across di world.

Pope Francis

Foto of Pope Francis

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pope Francis

Pope Francis for message wey e post for im official X account tok about Christmas..

"Di opening of di Holy Door on Christmas Eve symbolise a passage—an Easter of renewal—to enta into di new life offered to us thru di encounter wit Christ.

Christian hope, as e dey invite us to wait patiently for di Kingdom to grow and spread, also require of us, even now, to dey bold, responsible and compassionate, for our anticipation of di fulfilment of di Lord's promise.

If God fit visit us, even wen our hearts dey like di lowly manger, we fit truly say: Hope neva die; hope dey alive and e dey embrace our lives forever!"

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

President Bola Tinubu

Foto Nigeria President, Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Nigeria President, Bola Tinubu

Nigeria President Bola Tinubu don drop Christmas Day message for all Nigerians and pipo wey dey celebrate for di kontri.

"I extend my heartfelt greetings to Christians across Nigeria and worldwide as we celebrate di birth of Jesus Christ, as narrated in di Holy Scriptures.

Christmas carry fulfilment of divine prophecy and e symbolise di triumph of love, peace, and unity. Dis na reminder say light fit come out from di darkest times, wey dey bring solace and hope. Di belief agree wit pipo of all faiths. Indeed, God dey with us." E tok.

President Tinubu also tok about di tragic events wey happun recently for di kontri wey kill pipo.

"Recent tragic events for Ibadan, Okija, and Abuja deeply sadden us, and our thoughts dey wit di pipo wey kontinu to suffer from dis heartbreaking incidents.

We dey pray well well make dis kain misfortunes no revisit our families and communities and make notin cut short di lives of innocent pipo again."

E add say make Nigerians show kindness wey big pass money, and make dem try to make pipo smile, dos wey get and dos wey no get.

"Nigeria is on a promising path of restoration and progress, wit evri indication wey dey point toward a bright future. In di spirit of dis season, make we renew our hope and believe in a prosperous Nigeria."

Nana Akufo Addo

Foto of Ghana President, Nana Akufo-Addo

Wia dis foto come from, President Nana Akufo-Addo/Facebook

Wetin we call dis foto, Ghana President, Nana Akufo-Addo

Di President of Ghana, Nana Akufo - Addo deliver im Christmas message few hours bifor Christmas on Tuesday 24 December, 2024.

According to local media, President Akufo-Addo praise Ghanaians for dia commitment to democracy and peace, as im describe di 2024 elections as ogbonge achievement for di democratic journey of di kontri.

"Fellow Ghanaians, dis year, we don achieve anoda ogbonge milestone for our national development wit a peaceful, free and fair election of a new president and new members of parliament.

I extend my heartfelt congratulations to di president-elect and di MPs-elect. Wisdom, strength and God's blessings as dem prepare to lead our beloved nation," im tok.

However, President Akufo-Addo express disappointment sake of di kasala wey happun afta di elections.

Im condemn di incidents, as im tell all Ghanaians to uphold di peace and harmony for di nation democratic progress.

Dis na President Akufo- Addo last Christmas message to Ghanians.

Donald Trump

Foto of Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Donald Trump

America President-elect, Donald Trump and im wife Melanie Trump don share Christmas message too.

As dem tank di American troops, Donald Trump say, "during dis sacred season, Christians dey celebrate di greatest miracle for human history.

For Christmas we dey tank God as im send im son to bring peace to our souls and joy to di world."

For dis holy season we tank God for di infinite love and we tank God say di light of im glory go shine forever for sis magnificent land"