Trump assassination attempt, Chidimma Adetshina win and Baltasar Engonga leak - 10 tori wey shake 2024

Diddy, Ebonga, Chidinma and Turmp wit stitch for ear.

Wia dis foto come from, Getty Images/BBC

    • Author, Adesola Ikulajolu
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News
    • Reporting from, Lagos
  • Read am in 7 mins

Di year 2024 dey come to an end but not without some stories and events wey shake and shape di year.

From di US election wey come with im own drama to beauty queen wey unite Africa plus an unlikely sex tape leak, 2024 see di good bad and di controversial.

BBC Pidgin chook eye into some of di events wey really shake different parts of di world for 2024.

US election & Trump assassination attempt

Donald Trump become di first US president wit criminal conviction to win America presidential election for 2024.

At 78, Trump win election as di president-elect and e go be di oldest man to ever dey elected to dat position while im vice-president, 40-year-old JD Vance, go be di first millennial to take up di role.

But bifor di US election during campaigns, na two times dem make assassination attempt on Trump life wey be say e fail. Dat assassination attempt bin shake di world.

For July 2024, one FBI statement say di man wey attempt to kill Donald Trump na one 20-year-old Thomas Matthew Crooks.

Later for September 2024, dem identify Ryan Wesley Routh as suspect for di second assassination attempt on US Republican presidential candidate Donald Trump for Florida.

Different world leaders bin react to di assassination attempt at dat time.

TB Joshua exposé

January 2024 bin open wit ogbonge expose into di life of one megachurch leader for Nigeria.

BBC find out new evidence say di late Nigerian megachurch leader TB Joshua hide dead bodies and intimidate families, to cover up im role for di collapse of a building wey kill at least 116 people for im church for 2014.

Di collapse na one of di worst disasters to ever strike a place of worship for Africa.

BBC investigation na di first time insiders from TB Joshua Synagogue Church of All Nations (Scoan) for Lagos present evidence of wetin cause di incident nearly 10 years ago, and of how di pastor allegedly try to cover-up.

Dis tori touch evriwia wey be say online pipo sef no rest cos of di controversies wey surround am.

Di documentary also touch on di controversial methods of TB Joshua and weda e be man of God true-true.

Hamas and Hezbollah leaders death

For September 2024, Israel Defense Forces (IDF) say dem don kill Hezbollah leader Hassan Nasrallah afta one overnight strike wey happun for Beirut.

Israeli military tok say dem target Hezbollah central headquarters for Beirut southern suburbs on Friday, 27 September, 2024 for one attack wey shake di Lebanese capital and send thick clouds of smoke ova di city.

Dem add say Hezbollah leaders and commanders na dia target for di attack wey dem carry out.

For October 2024, Israel Defence Forces (IDF) also release statement say dia troop kill Hamas leader Yahya Sinwar for one operation for south of Gaza afta one "year-long pursuit".

Dis one shake di Middle East.

Chidimma Adetshina - Miss Universe Africa & Oceania

For July 2024, 23-year-old Chidimma Adetshina begin make headlines during di Miss South Africa pageant as citizens begin question her eligibility to contest.

Chidimma bin dey contest for Miss South Africa pageant wen different tok tok begin dey come say make dem disqualify her sake of allegations say she no be South African.

She don alreadi dey among di finalists, but she bin get to withdraw from di competition afta di South Africa Home Office say dem dey investigate her citizenship as a case of stolen identity.

Tins turn for Chidinma wen Miss Universe Nigeria invite her make she come contest for Nigeria instead.

Chidimma go later emerge winner of Miss Universe Nigeria 2024 afta contesting as Miss Taraba to beat 24 oda contestants to win di pageant wey hold for Lagos, Nigeria commercial city.

She represent Nigeria for di global stage of Miss Universe 2024 wia she break record for Nigeria and Africa.

Chidimma represent Nigeria for di Miss Universe competition to compete alongside 125 representatives from oda kontris for di 73rd Miss Universe pageant, wey happen for Mexico City, on Saturday 16 November, 2024.

She give veri tough fight but Miss Denmark, Victoria Kjr Theilvig win di 2024 Miss Universe title while Chidimma emerge first runner up for di competition.

Chidimma also emerge as di first Miss Universe Africa and Oceania.

Dis tori break through di lenght and breadth of di world as Nigerians and some Africans wey follow her story show support to Chidimma wey end well as she shine bright and make history for Mexico.

Iran President death

For May 2024, one helicopter bin suddenly crash and di Iran president bin dey inside.

Iran state TV bin confam say President Ebrahim Raisi, im foreign minister Hossein Amir-Abdollahian and odas bin dey inside di helicopter wey crash and dem die.

Wen di accident happun, Russia, Azerbaijan and Armenia - Turkey even send mountain rescue team to Iran.

Dis death shake Iran as dem still dey try dey balance dia kontri including serious economic problems. Na also time wey Israel and Iran dey show who get power pass afta several attacks.

Di death of Raisi open more controversial door of who go replace am at a time wey di kontri dey witness attacks.

Kenya Gen Z protest

Bold and new generation of young Kenyan protesters bin enta streets to force di govment to stop some of dia unpopular tax proposals.

Wetin start as anger on TikTok about one controversial finance bill bin spill into street protests – and no be political parties organise am.

Hundreds of trainer-wearing protesters, wey feel say Kenyans dey already overtaxed wit little to show for am, face police wey fire tear gas to march enta di capital, Nairobi.

Dem bring di city central business district to a standstill, but many of dem chop teargas and gunshots.

Di world bin dey watch Kenyan youths as dem also try to invade di parliament.

Kenya President Ruto bin deploy di military to stop di anti-tax protest after police shoot dead over 10 protesters.

Even some section of parliament dey set on fire as demonstrations against new tax proposals enta anoda level.

Di president go later dey forced to look into di finance bill and amend am.

Lebanon attack

Na about 492 pipo na im die and more dan 1,645 wound for Israel attack on Hezbollah for 2024.

Dis na di deadliest day of di Israel-Hezbollah kasala since 2006.

Di attack hit around 1,600 sites across Lebanon and di Lebanese health ministry say pipo wey die bin include 35 children, at dat time.

Baltasar Engonga sex videos

Authorities for Equatorial Guinea bin sack Baltasar Ebang Engonga as Director General of di National Financial Investigation Agency (ANIF) afta video wey carry im face having sex with different women go viral for social media.

Di goment bin suspend oga Engonga sake of leaked video wey claim say e sleep wit over 400 women – some of dem na partners of ogbonge pipo for Equatorial Guinea.

Even though Engonga neva comment on di allegations, di BBC try reach am for im reaction but no response.

Na later President Teodoro Obiang Nguema Mbasogo order di dismissal of Engonga.

E be son of Baltasar Engonga Edjo, current president of di Economic and Monetary Community of Central Africa (CEMAC) and im sakc come via a decree wey im great uncle, president Mbasogo sign.

Dis mata and videos trend for social media for 2024.

P Diddy case

Sean "Diddy" Combs inside a case wey dey filed for New York, don dey accused of kidnapping, drugging and making women do sexual activities, sometimes through di use of firearms and threats of violence.

Police raid im Los Angeles mansion for March. Dia, officers seize supplies wey dem say bin dey intended for use inside sex activities wey dey known as "freak offs", including drugs and more than 1,000 bottles of baby oil.

Mr Combs don deny all di charges, e enter a not guilty plea on Tuesday, 17 September.

Ballon d'Or 2024 drama

Afta di serious drama wey happun ahead of di announcement of di Ballon d'Or winner, Rodri win am ahead of Vinicius jnr.

Dis na di Ballon d'Or wey be say di usual face of Lionel Messi and Christiano Ronaldo no dey for di nominees.

As e bin help Manchester City win di Premier League and Spain triumph for di Euro 2024, Rodri win di Ballon d'Or.

Rodri look very emotional as e lift im Ballon d'Or.

E dey surprising say dem no announce Vinicius as di winner and even di whole Real Madrid team no show for di award night.

For di ranking, Bukayo Saka dey 21st while Cole Palmer dey 25th wit Declan Rice for position 26th.

E surprise pipo say some of di names wey dem expect to win am no win am.