Map show where Israeli strikes on Hezbollah hit as over 400 pipo die for deadliest day of conflict in 20 years

People inspect one site afta overnight Israeli strike on a house for di southern Lebanese village of Akbiyeh on September 24, 2024.
Wetin we call dis foto, People inspect one site afta overnight Israeli strike on a house for di southern Lebanese village of Akbiyeh on September 24, 2024.
Read am in 6 mins

Israeli air strikes on Hezbollah continue overnight as thousands of pipo run comot dia homes for southern Lebanon.

On Monday, Lebanon health ministry say at least 492 pipo na im die and more dan 1,645 wound - di deadliest day of di Israel-Hezbollah kasala since 2006.

Lebanon education ministry say all schools go dey shut.

Public schools bin never start for di school year yet, while private ones for many areas of di country don get order to suspend classes starting today.

Rockets wey Hezbollah fire overnight towards northern Israel bin either dey destroyed or fall for open areas, IDF tok.

Israel say e dey "broaden" im strikes against Hezbollah - citizens for southern Lebanon bin receive phone messages earlier dis week warning dem to leave places used by di Iran-backed group.

Fears of all-out regional conflict for di Middle East don increase in di past week - cross-border attacks increase after di exploding device attacks on Hezbollah members.

Air strikes as seen from Tyre

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Air strikes don dey hit across di South of Lebanon since Monday morning - As dem see am from Tyre

Israeli military say dem dey conduct as cross-border attacks between di two sides continue to increase.

Israeli military bin don advise Lebanese civilians to move away from areas wey di Iran-backed group dey use for military purposes, as dem warn say dem go conduct "extensive" air strikes on Hezbollah targets for Lebanon.

Where Israeli strikes on Hezbollah hit yesterday?

Map show where Israeli airstrikes hit

For im most recent update on yesterday air strikes, di Israeli military don say throughout di day on Monday, e hit around 1,600 sites across Lebanon.

Di strikes bin mostly dey concentrated for di south, but some reach up into di east and northeast of di country.

One hit one site only just south of di town of Hermel, around 130km (81 miles) north of di Israeli border.

Di Lebanese health ministry say 492 pipo die, including 35 children, making Monday di deadliest day of di Israel-Hezbollah conflict since 2006.

Israel say e hit Hezbollah targets, but Lebanon say most of di sites na residential.

Why Israel and Hezbollah dey fight?

Di wahala wey dey happen between Israel and Hezbollah dey connected to di war in Gaza - but e get oda reasons too.

Di catalyst for wetin dey happen now na one rocket attack by di Lebanon-based Hezbollah in and around northern Israel one day after di 7 October Hamas attack on Israel. Israel retaliate and fighting between di two sides don dey shele ever since.

Hezbollah say dem bin dey act out of solidarity with di Palestinians for Gaza, wia a war don dey on between dia padi-padi Hamas and Israel since di 7 October attack.

Cross-border attacks, such as di ones we don dey see since dis past week, for be a strategy by di Hezbollah to put additional pressure on Israel and divert resources away from di war in Gaza.

But gbege between Israel and Hezbollah don dey long before di conflict in Gaza and na part of wider regional dynamics.

Hezbollah align with Iran - wey be Israel arch enemy - wey dey fund, train and equip dia armed wing, di most powerful military force in Lebanon. E present itself as a resistance movement to Israel, though, like Iran, e dey also call for Israel elimination.

Di two sides don fight and attack one anoda since Hezbollah first start in di early 1980s, including in a 34-day war for 2006.

Since den, dem don dey get small-small fight-fight between demsefs around di Israel-Lebanon border, wey break out into fighting in October wey don become more sustained and intensive in recent weeks.

Makary, Lebanon Information Minister

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Makary say di methods of sending messages through phones no dey strange for Israel

Wetin happun on Monday?

Thousands of families run comot dia homes as Israel military say e hit 1,300 Hezbollah targets for Lebanon according to reports.

Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu ask di pipo of Lebanon to “get out of harm way now” and di Israeli military bin send texts messages warning pipo to move away from buildings where Hezbollah dey store weapons.

Lebanese security sources say di strike target Hezbollah top commander for southern Lebanon, Ali Karaki, e no dey clear whether dem kill am. Hezbollah later say Karaki bin dey “fine” and don “move to a safe place”.

Meanwhile, Hezbollah launch more dan 200 rockets into northern Israel, according to di military.

US say dem dey send "a small number" of additional troops to di Middle East "out of an abundance of caution".

President Joe Biden say US dey “work to de-escalate in a way wey allow pipo to return home safely”.

A timeline of how hostilities - fighting - continue to dey increase between Israel and Hezbollah recently

Pipo with coffin

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Crowd of pipo wey hold a coffin covered in yellow cloth

Fears of an all-out regional conflict for di Middle East bin increase in di past week after cross-border attacks involving Israel and Hezbollah intensify.

Dis na wetin don happen so far in brief:

  • On Tuesday, 12 pipo dey killed and thousands wound after pagers used by Hezbollah members explode across Lebanon.
  • Di following day, hundreds of walkie-talkies used by Hezbollah members explode, killing 27 pipo and e wound hundreds.
  • Hezbollah don blame Israel for di attacks, while Israel don decline to comment - though e dey widely assumed to be responsible.
  • On Friday, Israel say dem conduct an air strike for di neighbourhood of Dahieh, a Hezbollah stronghold for southern Beirut, killing a commander from di Iranian-backed militia and oda senior figures
  • Lebanon health ministry say 45 pipo, including three children, bin dey killed for dat strike.
  • Cross-border attacks continue over di weekend, with Hezbollah launching 150 projectiles into Israel, while Israel carry out air strikes into southern Lebanon wey dem say destroy thousands of di militia rocket launchers.