Nominees for di proposed cabinet wey President Ruto William announce

William Ruto

Wia dis foto come from, X/WilliamRuto

Read am in 3 mins

Kenya president William Ruto don announce nominees wey go form new cabinet members afta e dismiss all im secretaries.

President Ruto say im dey form new ‘broad-based cabinet’ wey make am pick di first batch of nominees wey go serve for im cabinet.

Na 11 nominees bin dey di list of di new cabinet members wey go serve Kenyans.

Meanwhile, di president retain six out of im former 22 cabinet secretaries wey im dismiss. Na about five new faces come dey di new list as all of dem go reach di National Assembly for consideration and approval.

For di press conference for State House Nairobi wey di president tok on Friday 19 July 2024, e say di democracy of Kenya don dey tested wit di recent events wey unfold and e include di protest wey di youths bin do.

“During dis time, di kontri don engage in difficult public conversation, wey go provide opportunity to reflect ontop di relationship between fundamental rights and democratic freedoms, our collective aspirations for prosperity and efforts wey go secure opportunities for all, and advance di security of di State,” President Ruto tok.

E add say, “E dey therefore important to constitute more inclusive goment wey go unlock di potential of citizens from all sectors to drive national transformation.”

Who be di new cabinet nominees

Some nominees from di cabinet wey Ruto dismiss but dem make di new list include:

Prof Kithure Kindiki - Interior and National Administration,

Mr Aden Duale - Defence,

Mrs Alice Wahome - Lands, Public Works, Urban Development and Housing.

Odas include Ms Soipan Tuya in charge of Environment, Climate Change and Forestry and Mr Davis Chirchir for Roads and Transport.

Ms Rebecca Miano dey nominated to come begin dey handle di Attorney-General afta she bin dey in charge of di CS Investment, Trade and Industrialisation.

Mr Chirchir na di former Energy cabinet secretary.

Di new faces nominated to Kenya cabinet

Dr Debra Mulongo Barasa – Health nominee,

Mr Julius Migosi Ogamba – Education nominee,

Dr Andrew Mwihia Karanja - Agriculture and Livestock Development nominee,

Mr Eric Muriithi Muuga - Water, Sanitation and Irrigation nominee,

Ms Margaret Nyambura Ndung’u -Information, Communication and Digital Economy nominee.

Why Kenya President Ruto dissolve cabinet bifor

Kenya President William Ruto bin dissolve im cabinet wit immediate effect on Thursday, 11 July 2024 during im address for di State House.

Dis dey come afta one recent deadly protests wey lead to di withdrawal of one unpopular bill.

Di dissolution of di cabinet no affect di deputy president, and di prime cabinet secretary wey also be di foreign affairs minister.

Di presido say im take di move afta "reflection, listening to my kontri pipo and afta "holistic appraisal" of my cabinet".

"Even wit di progress wey we don make, I dey aware say di pipo of Kenya get high expectation from me. Recent events wey cause di withdrawal of di Finance Bill don cause many tins and afta listening to wetin di pipo tok and di performance of di cabinet."

Ruto add, "In line wit power wey section 12 of di office of di attorney-general give me, I decide to dismiss all di cabinet secretaries and attorney-generals of di cabinet of Kenya."

Di dramatic move dey highly unusual, e come less dan two years afta e take office.

Di last time dem dissolve entire cabinet na for 2005 wen di den President Mwai Kibaki sack all im cabinet members shortly afta e lose one referendum ova a new constitution.

Oga Ruto bin dey under pressure from Kenyans wey don continu to hold anti-goment protests and dey demand for more accountability from goment, even though e don agree to withdraw im controversial tax rises.

Some of di protesters don dey demand for di president to go.

President Ruto also pause one proposed pay rises for members of im cabinet and parliament afta public outcry.