Key points you suppose know about Kenya housing tax law wey President Ruto sign

Wia dis foto come from, Getty Images
Kenyan President William Ruto don sign one new law wey go require Kenyans to pay a 1.5% monthly tax to fund construction of low-cost houses.
Di controversial Affordable Housing Act 2024 don reintroduce mandatory levy wey di goment bin start to dey deduct last year July from both employers and employees.
Di courts bin declare di housing tax unconstitutional sake of say e bin no get legal framework to support di deductions.
Court bin also rule say di levy unfairly target Kenyans wey dey work for di formal sector and order payments to dey suspended.
Di new legislation wey parliament bin approve last week go address di issues wey di courts bin raise.
Businesses don dey included for di scheme and dem dey required to contribute 1.5% of dia monthly gross incomes.
Wetin you gatz know about dis new law
Goment say dem wan use di levy for di construction of affordable housing for poorer Kenyans.
Dem say di new tax go take effect at di end of dis month and dem no go backdate am.
End of Di one wey oda users dey read well well
According to President Ruto, di housing fund target to build about 200,000 homes annually - e say dis go create at least 500,000 jobs each year.
Di legislation go establish di following four types of low-cost houses,
Social housing unit for pipo wey dey earn below Kshs 20,000 ($147),
Affordable housing unit for those earning less than Kshs 149,000 ($1,093),
Middle-class housing unit for people earning above Kshs 149,000 ($1,093);
Rural affordable housing unit for those living outside urban areas.
Wetin pipo dey tok?
Dis levy don cause tok-tok from di opposition and many Kenyans, wey plenti taxes introduced by President Ruto dey choke dem.
Di opposition don threaten to take dis new law go court, as dem allege say goment ignore concerns of Kenyans ova di increasing tax burden.
Critics also tok say di bill fit no properly address di root causes of di housing crisis and e fit only benefit some pipo through corruption.
President William Ruto don tok say di project na one of di goment efforts to improve affordable housing for di kontri.
Na one new Affordable Housing Board go manage di fund, based on annual investment programme.













