Gas blast for Kenyan capital kill three, wunjure almost 300

Wia dis foto come from, Reuters
Gas explosion for Kenya capital, Nairobi, don kill at least three people and wunjure almost 300.
Na lorry wey carry gas bin explod for Embakasi district around 23:30 (20:30 GMT), "come cause big ball of fire", one goment pesin tok.
Houses, businesses and cars bin damage, one video show as big fire dey burn close to blocks of flats.
Di goment say di blast happen for a gas plant. E neva dey clear wetin cause di blast.
Embakasi police chief Wesley Kimeto tok say one pikin follow for di pipo wey die for di explosion, and e tok say di death toll fit rise.
Di Kenya Red Cross say dem don carry 271 pipo go hospital and treat 27 odas for di site of di fire.
Di fireball from di explosion "spread far", according to Isaac Mwaura Mwaura, di goment tok tok person, and one gas cylinder fly go land for one garments and textiles warehouse, and burn am down.
"Di fire also damage plenty vehicles and commercial properties, plus including many small and medium size businesses," e tok for inside statement.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Sadly, residential houses for di neighbourhood bin catch fire too, and pipo bin dey inside di houses, and na for late night dis thing happen."
Pipo wey dey close tell tori pipo say they bin feel di ground shake immediately after di explosion.
Many of di pipo wey wunjure na inhalation injuries dem get and di thing affect at least 25 children, di Standard newspaper report.
One of di pipo wey wunjure, Boniface Sifuna, narrate im tori give Reuters news agency: "Na as I dey try escape na im one gas cylinder wey explode burn me," e tok.
"E blow for my front and e knock me for ground and di fire just cover me. I dey lucky say I strong enough to get away."
James Ngoge, wey dey live across di street from where the explosion happen, tell AFP tori pipo say him dey im house when e hear big explosion"
"E bin feel like di house wan collapse. We bin no know wetin dey happun, e be like earthquake.
"I get business for di road wey dey completely destroyed."

Wia dis foto come from, Reuters
One journalist wey dey live for di area tok say everibodi bin comot for dia house afta di explosion.
Di Kenya Red Cross tok for social media say di fire pipo bin dey battle di fire tirelessly.
Goment tok tok person, Mr Mwaura say dem don secure di explosion scene and dem don set up a command centre to help co-ordinate rescue operation.
"We dey advise Kenyans make dem no dey near di area wey we di explosion happen make rescue operation for fit go on without disruptions," he tok.













