Who be di suspect wey carry out di second assassination attempt on Trump

Donald Trump and Ryan Wesley Routh

Wia dis foto come from, AFP

    • Author, Malu Cursino
    • Role, BBC News
  • Read am in 5 mins

Dem rush former President Donald Trump to safety on Sunday afta wetin di FBI call obvious assassination attempt on Trump golf course for West Palm Beach.

Di incident come almost exactly two months afta di shooting wey happun for Trump rally for Butler, Pennsylvania, wia Trump wunjure and one supporter die.

Details still dey come out from di latest incident and about di suspect, wey US media don name Ryan Routh. Dis na wetin we know so far.

Who be Ryan Routh?

Selfie show Ryan W. Routh in military bulletproof vest wearing red white and blue t-shirt and bandana around im neck wit wall of flags of di world behind am

Wia dis foto come from, Reuters

US media don identify Ryan Wesley Routh as suspect following di assassination attempt on US Republican presidential candidate Donald Trump for Florida.

58-year-old Oga Routh originally come from North Carolina and spend most of im life dia, according to property records, but most recently e bin leave for Hawaii.

Im known activity show say e get interest for politics, Russia/Ukraine war and e also get plenty legal issues.

Records show say Oga Routh legal issues go back to di 1990s, wey include lesser charges writing bad cheques, according to CBS.

Oga Routh dey charged and convicted of plenty felony offences for Guilford County for North Carolina between 2002 and 2010, CBS report.

For 2002, US media say dem charge am for possession of one fully automatic machine gun, wey dem refer to for court filings as "weapon on mass destruction".

Di offences include carrying a concealed weapon, resisting arrest by police officer, driving wit revoked licence, possession of property wey im steal and hit and run wit motor vehicle.

CBS report say Oga Routh vote Democratic during di party 2024 primary for North Carolina, according to di state Board of Elections.

Report say e dey registered as an unaffiliated voter, despite di social media post wey say e back Trump for 2016.

BBC Verify don find social media profile matching di name. Dem indicate say Routh call for foreign fighters to go to Ukraine to battle against Russian forces.

E get pro-Palestinian, pro-Taiwan and anti-China messages on im profile, including allegations about Chinese “biological warfare” and references to di Covid-19 virus as “attack”.

Routh, wey no get any military experience, tell di New York Times in 2023 say e don travel to Ukraine immediately afta Russia invasion in 2022 to find military recruit among Afghan soldiers wey run comot from di Taliban.

E dey involved in recruitment effort, recently dis summer, writing on Facebook in July: "Soldiers, please no call me. We still dey try to get Ukraine to accept Afghan soldiers and hope to get some answers in di coming months... please get patience."

Speaking to US media, Mr Routh son, Oran, describe am as "loving and caring father".

"I no know wetin happun for Florida, and I hope say dem don blow tins out of proportion, becos from di little wey I don hear, e no sound like di man I know fit do anytin crazy, much less violent," Oran tell CNN.

Wetin we call dis Video, Watch: Ros Atkins on…di apparent Trump assassination attempt

How dem spot di suspect?

Di incident happun for di Trump International Golf Club for West Palm Beach, about 15 minutes from Trump Florida residence, Mar-a-Lago.

Secret Service agents see di gunman, as dem dey sweep di course ahead of di former president as e dey play. Di agents usually go one hole ahead to perform security checks, according to police.

Di muzzle of di rifle - wey County Sheriff Ric Bradshaw initially describe as AK-47-style rifle - dey spotted as e show for di bush by di di course. At di time Trump dey about 300-500 yards (272-557m) away from di gunman, e tok.

One agent “immediately engage” wit di pesin holding di rifle, wey run comot, Sheriff Bradshaw tok.

"Di Secret Service do exactly wetin dem suppose do."

Sheriff car blocks di street outside di Trump International Golf Club in West Palm Beach, Florida, on September 15, 2024 following shooting incident at former US president Donald Trump golf course.

Wia dis foto come from, Getty Images

How dem catch di suspect?

Agents open fire wen dem spot di gunman and fire four to five rounds of ammunition.

Di suspect drpp di rifle and run comot inside vehicle, abandoning di weapon along wit two knapsacks, scope use for aiming weapon and GoPro camera, Sheriff Bradshaw tok.

Witness see di man running from di bush to inside one black Nissan, di sheriff tok. Di witness capture foto of di car and provide am to law enforcement agents.

Police arrest di suspect around northbound on di I-95 highway afta crossing into Martin County, roughly 61km (38 miles) from Trump golf course.

Several law enforcement sources don tell BBC US partner, CBS News, say di suspect name na Ryan Wesley Routh.

Palm Beach County Sheriff PIO Teri Barber hold photographs of di rifle and oda items dem find near wia dem discover di suspect during press conference regarding di assassination attempt of former President Donald Trump on September 15, 2024, for West Palm Beach, Florida.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Officials show images of di suspect belongings during news conference

Wetin go happun next?

Routh go remain for custody and dem neva file any official charges against am yet.

E dey expected to appear in front of one judge later on Monday for di Palm Beach County courthouse near Mar-a-Lago.

E neva dey clear if e actually fire im weapon during di incident.

“We no dey sure right now if di individual bin dey able to shoot our agents, but for sure our agents bin dey able to engage wit di suspect," Rafael Barros from di Secret Service Miami Field Office tok.

E say dem bin don take measures afta di previous assassination attempt on Trump for Pennsylvania and "di threat level dey high".

Di FBI don announce say dem dey do investigation, and dem say dem dey work wit local law enforcement agencies.

Secret Service and Homeland Security agents don also search Routh former house for Greensboro, North Carolina.