TB Joshua exposé: Nigerian pastor cover up deadly Lagos building collapse
Di BBC don find out new evidence say di late Nigerian megachurch leader TB Joshua hide dead bodies and intimidate families, to cover up im role for di collapse of a building wey kill at least 116 people for im church for 2014.
Di collapse na one of di worst disasters to ever strike a place of worship for Africa.
BBC investigation na di first time insiders from TB Joshua Synagogue Church of All Nations (Scoan) for Lagos don present evidence of wetin cause di incident nearly 10 years ago, and of how di pastor allegedly try to cover-up.
E follow evidence wey BBC uncover of widespread abuse and torture by di founder of one of di world biggest Christian evangelical churches.
Two days afta di collapse on 12 September 2014, TB Joshua publicly say e dey linked to one aircraft wey fly over di building wey dem use to house visiting pilgrims.
But one inquiry by a Lagos coroner agree with emergency workers say na structural failure cause di guest house to collapse, and say dem build am without proper planning permission.
Eyewitnesses tell BBC say TB Joshua bin dey warned of serious structural problems before di disaster. Dem say di aeroplane explanation na "lie".





