Di animals wey dey give each oda gifts

Two guinea pigs wey dress up as Santa Claus and an elf

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Jasmin Fox-Skelly
    • Role, BBC Future
  • Read am in 6 mins

We fit reason say na only human beings dey give gift but no be so. Dem don find out say many oda animals dey also give dia partners and friends.

If on Christmas morning dem give you di usual gift wey dem dey buy you evri year, maybe boxers and singlet, make you no too vex.

At least you no be female scorpionfly wey dey collect ball of spit from dia partner, and di male go use di spit wey im dash am take nack di female.

But no too feel bad bicos apparently dem dey chop as food wey dem like wella.

Dis na wetin dem dey call nuptial gift giving wen di male go give di female sometin to chop during courtship or mating. Dem don find am for species like snails, earthworms and squid and even bird sef.

Dis na some of di animals wey dey gift each oda.

Birds

Male of bee-eater giving an insect to the female

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Male of bee-eater dey give insect to di female

Birds don dey known to enjoy exchange of gifts too..

Like male great grey shrikes wey dey like small animals for thorns and twigs to impress dia mates.

Dem go come give am to di females as gift during courtship.

Nursery web spiders

Nursery web spiders present a potential mate seen on a leaf

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nursery web spiders present a potential mate wit food wey dem wrap up

Dis behaviour of nuptial gift giving na insects and arachnids dey do am pass like male sixopt burne moths wey dey give dia female partners cynaid wit dia sperm.

Nursery web spiders dey give dia potential mates, food wey dem wrap wit silk and oda chemicals to make am more attractive. If di female no gree collect na to wrap di gift wit more tins and come give am back.

But even as dem dey give gift, some males go still try cheat. Dem go wrap prey wey dem sabi say no be beta prey, or sometin wey dem don chop remain.

As di female dey open di gift na so dem go quick nack run bifor she see say na nonsense e wrap give am.

One study don find out say about 70% of di gifts wey male nursery web spiders dey give na fake.

Dance flies

Darryl Gwynne wey be behavioural ecologist for di University of Toronto for Canada tok about how male dance flies dey fly ova di river to get aquatic insects for dia females.

E explain say, "dem go bring am back and females go fight for di prey bicos dem no fit feed demselves and dem need di nutrition to make dia eggs".

But you see dat kurukere waka wey male nursery spiders dey known for e dey hia too. Oga Gwynne recall say, "one time like dat, I see one make come wit willow fluff from di willow seed and try present am as im own gift."

Worthless gift dey only work small for male insects as e dey lead for female insects to reject dem half way and since female insects dey nack plenti males, di probabilty say dia seed go germinate dey low.

Sagebrush crickets

Some insects dey give demselves as living sacrifice to di females dem wan kpansh.

Di male sagebrush cricket dey allow females to suck im haemolymph (wey be dia own version of blood).

One study tok say as dis male dey endure di love bite dem fit no find anoda partner again bicos dem go don too taya to find new female.

Red Back Spider

Di male red back spider dey normally back flip chook imself for di female mouth during copulation so she go dey chop di end of im belle as dem dey nack till she chop am finish.

Gwynne say to fit reason am say na bicos e die na bad tin do am but e explain say, "Darwinian fitness perspective reason say finding any female to mate wit na luck for red back spiders so as e give her di belle make she chop, e dey distract am so e go fit give am more sperm so e go get more pikin".

Dolphins

All dis na nuptial gifts wey male dey give female to convince dem say make dem mate. But animals dey wey dey give gifts just bicos na dia paddy.

Dolphins dey known to give pipo food.

Dem dey give pipo tins like eels, tuna and octopuses.

Crows

Tori also full ground as to how crows dey give pipo wey don help dem bifor, gifts.

Nicola Clayton, wey be di professor of comparative cognition for di University of Cambridge for di UK, tok say, "I don collect gifts from crows like walnuts, olives, bottle tops from beer bottles, and wine corks. Luckily dem neva give me roadkill bicos I be vegetarian and I go prefer jewellery."

Eurasian jays

Eurasian jays wit ground nut for im mouth

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Eurasian jays dey mate for life so dia gifts no be bribe for mating na actual gift.

Eurasian jays na member of di crows family dey also give gifts for dia mates just for di joy of giving.

For one experiment by Clayton and her team, males bin dey watch dia mates dey chop either moths or worms. Wen dem get opportunity of new type of food, di males bin dey consistently give am to di females bicos dem sabi say di female like to get new food dan to chop wetin dem don dey chop bifor.

Clayton tok say, "jays dey mate for life, so gifts no be bribe to mate, na just gift. Jays na intelligent anoimals wey dey live long and as you know relationships na work so gift na sign of appreciation."

Bonobos

A baby bonobo sleep ontop im mama "Kutu" for one zoo for Frankfurt am Main, western Germany, on July 21, 2015

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Humanity closest relative, bonobos, sometimes offer gifts to oda bonobos wey be members of different groups

For 2013, dem do one study wey find say bonobos sometimes dey give presents like charity to strangers.

Di apes dey share dia food wey include apples and bananas wit oda bonobos wey no dey part of dia group.

Sometimes dem dey even decide to choose di give up dia own food so dem go fit interact wit di stranger.

All dis gift giving tok-tok no make yo feel warm inside your belle in time for Christmas?