Five tins President Bola Tinubu tok for im first media chat

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria President Bola Tinubu don do im first media chat with journalists.
For di chat, di president tell Nigerians say 2025, na promising year as e thank Nigerians again for electing am to serve.
Di president wey say e no go take Nigeria confidence in am take joke also ask for cooperation and understanding.
E add say e understand di challenges, economic problems wey dey ground, but assure say promise dey and Nigeria dey on di right path and tomorrow go bring a glorious day.
Dis na di top points from di president chat with tori pipo.
On di recent stampede and food security
Di president no hold back to chook mouth on di recent stampede tragedy wey take di lives of pipo including children wey go event to collect food and oda palliatives.
E condole with di family of those wey lose loved ones as e say di organisers make mistakes.
"E dey very sad say pipo no dey well organised. We just need to dey more disciplined for our society. Condolences to those wey lose family members.
I don dey give out food, clothing and envelopes for Bourdillon for di last 10 to five years, I never experience dis kain incident becos we dey organised and disciplined. If you know you no get enough to give, no even attempt am or publicise am na im be di question." Di president tok.
"Every society get hungry pipo, America, Britain get food banks but dem dey organised, dem dey take token to dey for line and dey collect turn-by turn.
E dey unfortunate, e dey show for our bus tops wia pipo no wan even dey queue before dem rush enter vehicle.
E dey very sad but we go continue to learn from our mistakes. For me I see am as big error on di part of di organisers." E add.
On food security to address di hunger wey dey di land, di president hail di new Ministry of livestock development wey get mandate to solve di problem.
"Ministry of livestock development bin never dey before, I dey travel round di world to campaign and sell Nigeria. Di ministry na to turn a disaster to prosperity, we get arable land, we get animal stock na just to remove di conflicting element and commercialise di venture.
I go Brazil, see wetin dey happun dia, within two days, I get a pledge of 2.5brillon dollars, and dem don come Nigeria to turn wetin we see as tragedy to opportunity and prosperity.
We fit feed ourselves, export and feed oda nations. Our pipo, some of di ministers dey Saudi Arabia right now dey discuss di opportunity for food growth and supply." Tinubu tok.
Fuel subsidy removal
Di palava of di increase in fuel pump price wey get ripple effect on di cost of goods and services for Nigeria start on di day of Tinubu inauguration wen e say, "fuel subsidy is gone!" Wen tori pipo ask am weda wen e look back e for do tins different and address di fuel subsidy mata small small, e say no.
"Wia is contingency, wia e dey? we bin dey spend our future, we bin dey spend our generation fortunes, we bin no dey invest we bin just dey deceive ourselves, dat reform dey necessary, I see di smugglers dey fight back, dat wan no affect me, e affect smuggling.
Why you go get expenditures wen you no get revenue, I no wan question pipo wey dey drive limousine type of vehicles on di road, make we teach management with all our programmes, we need to manage our resources within our means, no way we go give out fuel and allow all di entire neighbouring countries as father Christmas, I no get any regret whatsoever to remove di subsidy, e dey necessary." Tinubu tok.
On government debt
Tinubu also justify borrowing money from international financial institutions by im administration to finance di budget.
E say to collect loans no be criminal act.
"Borrowing no dey criminal... We get serious infrastructural deficit, if we no put money on di long term, we no get di short term to manage a long term business, dat na mismatch and dat na one.
Yes we don go on di wrong road for di past, I no wan look dat one, I wan tink about prosperity for our country, I wan tink about tomorrow, today. Wetin be di element of dis borrowing, our road dey terrible, our internet no dey di level we want as a technology driven nation, we still dey indebted in electricity and di vision in power generation. How you go do am? You need to take am with two hands and ready for a very very long push." E tok.
Security
On security di Nigerian president say di war no fit dey fought without investment in technology, weaponry and training.
Although e agree in response to one of di tori pipo question about mismanagement of funds say leakages fit dey here and dia, e say government don put a very effective mechanism in place to monitor di budget releases and dem dey use di funds well-well.
"Consider di welfare of our service men and women, dem dey live and operate in a very serious condition, we get very big country and plenty forest, unoccupied spaces, give dem credit for wetin dem dey do, I dey proud of wetin dem dey do today. No need to probe.
I no dey probe anybody, service chiefs or not. Na project of restoration and hope despite wetin critics dey tok and Nigeria dey on di part of recovery." E tok
"For today, I get confidence in di security architecture, of dis country. E dey very unfortunate, di incidents of anyhow killings, I remember wen I dey campaign, I bin stop to pay condolence visit to Maiduguri, Katsina, Kaduna. Today you still fit do road travel, before now e dey impossible, today dat no be di story again, pipo fit leave Kaduna and still travel by road go Kafanchan."
On di controversial tax bill
"Tax reform dey here to stay, we no fit just continue to do wetin we dey do yester years for today economy. We no fit retool dis economy with di old broken boat." Na so di president reply wen dem ask am about di tax bill wey still dey generate reactions even among govnors for di country.
"I believe say I get di capacity, dats why I contest, I dey focused on wetin Nigeria need and wetin I must do for Nigerians. E no go be eldorado for everybody, but di new John dey here, I dey convinced and you suppose dey too.
Tax matters dey subject to reviews, debate, negotiations until you reach concession. I no mind cutting edges." E add.







