Wetin we know so far about di Azerbaijan airline plane crash wey happun for Kazakhstan
Dozens of pipo survive di crash wey involve one plane wey carry 67 pipo for Kazakhstan, local officials tok.
Na twenty nine of di 67 pipo wey dey on board survive. Azerbaijan hold a national day of mourning on Thursday for di victims of di crash.
Those on board be mostly Azerbaijani nationals, but some of di passengers also come from Russia, Kazakhstan, and Kyrgyzstan.
One surviving passenger tell Russian TV say e believe say di pilot bin try two times to land inside thick fog ova Grozny bifor "di third time, something explode... some of di aircraft skin bin blow out".
One woman wey bin dey travel to spend di holidays with her children for Chechnya, wey Grozny be di capital, die for di crash. One mama, wey bin dey travel with medical tests for her sick child, still dey miss.
One young woman share her heartache with BBC Azerbaijani service as she try to find out wetin happen to her father, wey bin dey on di flight.
She explain say her father bin dey travel with im son, wey survive di crash. Di son manage to contact im sister, but still no news of dia father.
Unverified video footage show survivors dey crawl out of di plan remains, some with injuries.
Meanwhile for Moscow, Kremlin tok tok pesin Dmitry Peskov say: "E go dey wrong to put forward any claim bifor dem conclude investigation. We, of course, no go do dis, and no-one suppose do dis. We need to wait until di investigation dey complete."
Di Russian govment caution say make dem no promote di cause of di Russia-bound passenger plane crash if enough evidence no dey.
Di plane crash kill 38 pipo for Kazakhstan on Wednesday.
Footage of how di plane bin destroy appear to indicate small bomb damage.
Some aviation sabi pipo suggest say di Azerbaijan Airlines plane fit don dey hit by air defence systems ova di Russian republic of Chechnya.
Bifor e go down near di Kazakh city of Aktau, dem divert di plane across di Caspian Sea, from di destination in Chechnya to western Kazakhstan.
Azerbaijan prosecutor general say dem dey look into "all possible scenarios" and President Ilham Aliyev say e dey too early to say anything concrete.
Air defence experts don suggest say di pattern of damage inside and outside di plane show say Russian air defence wey dey active for Grozny fit don cause di crash.
"E look very much like di detonation of air defence missile to di back and to di left of di aircraft, if you look at di pattern of shrapnel wey we see," Justin Crump of risk advisory company Sibylline tell BBC Radio 4.
Azerbaijan Airlines say flights between Baku and di Russian cities of Grozny and Makhachkala go dey cancelled pending investigation into di incident.
Dem don recover di plane flight data recorder, officials tok.
Azerbaijan Airlines flight J2-8243 bin catch fire as e attempt to do emergency landing near di Kazakh city of Aktau.
Di plane bin dey go Grozny for Russia but e divert sake of fog, di airline bin tell BBC.
Video wey Reuters news agency verify show say di plane dey head towards di ground at high speed, wit im landing gear down.
Seconds afta e attempt to land, e burst into fire.
Na 62 passengers and 5 crew members dey onboard di Embraer 190 aircraft, di transport ministry report.
Pipo wey mostly dey on board na Azerbaijani nationals, but some passengers na from Russia, Kazakhstan, and Kyrgyzstan.
Aktau airport dey open and e dey operate normally, authorities tok.











