US launch airstrikes against Islamic State terrorists for Nigeria

Trump stretch hand behind podium wit America and Nigeria flags behind am

Wia dis foto come from, Win McNamee/Getty Images

Read am in 4 mins

US President Donald Trump say dem don launch a "powerful and deadly strike" against di Islamic State for Nigeria.

For post ontop im Truth Social account, Trump say: "under my direction as Commander in Chief, di United States launch a powerful and deadly strike against ISIS terrorist Scum for north west Nigeria , wey don dey target and viciously kill primarily, Innocent Christians at levels wey dem never see for may years".

But di Nigeria govment bin reject di claim say widespread killing of Christians dey hapun for di kontri as e declare am, "kontri of particular concern".

Di goment bin tok say oga Trump position no really gel wit wetin dey hapun for ground for Nigeria.

Trump for im post wia e confam di strike for Nigeria say "I bin don warn dis terrorists say if dem no stop to dey slaughter Christians dia would be hell to pay and tonight dem see am.

Di Department of War execute many perfect strikes as only US dey capable of doing. Under my leadership, our country no go allow radical Islamic terrorism to prosper." Di post add.

Wetin more we know about di strikes?

Clip from di US defence department post wey one short video wey show as dem launch missile from one military vessel

Wia dis foto come from, US Department of Defense

Wetin we call dis foto, Di US defence department post one short video wey show as dem launch missile from one military vessel

Di United States Secretary of war Pete Hegseth also confam di strikes ontop im X account, but im add say dem get di support of di Nigerian govment.

Meanwhile, Di US Africa Command, Africom, also Tweet for di handle say di operation hapun togeda wit di support of Nigerian authorities.

"At di direction of di President of di United States and di Secretary of War, and in coordination wit Nigerian authorities, U.S. Africa Command conduct strikes against ISIS terrorists for Nigeria on Dec. 25, 2025, in Sokoto State.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Nigeria confam airstrikes on terrorist targets

Nigeria Ministry of Foreign Affairs wey also confam di strikes say dem collaborate wit America to carry am out.

For statement ontop dia X account, di ministry say Nigeria dey cooperate wit international partners including America to address di threat of terrorism and violent extremism.

Dem say di collabo lead to "precision hits on terrorist targets for Nigeria and by air strikes for di north west.

"In line wit established international practice and bilateral understandings, dis cooperation include di exchange of intelligence, strategic coordination and oda forms of support wey dey consistent wit international law, mutual respect for sovereignty and shared commitments to regional and global security." Di statement add.

Di statement go further to say di counter-terrorism efforts dey guided by: " Di primacy of protecting civilian lives, safeguarding national unity and upholding di rights and dignity of all citizens, irrespective of faith or ethnicity."

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Di White House recently impose partial visa restrictions on Nigeria, wey dem say "Radical Islamic terrorist groups like Boko Haram and di Islamic State dey operate freely in certain parts of Nigeria, wey don make substantial screening and vetting difficulties."

Meanwhile, Nigeria foreign ministry bin tok say dem go respond to di US partial travel ban through diplomacy.