Five key events wey happun since Trump threat to invade Nigeria

Donald Trump

Wia dis foto come from, Andrew Harnik/Getty Images

Read am in 6 mins

Claims say dem dey kill Christians for Nigeria don turn big gist wey pipo dey argue about - no be only for inside Nigeria, but even for international places.

Di tori don spread well well for social media and advocacy campaigns sotey US President Donald Trump don decide to redesignate Nigeria as "country of particular concern (CPC)."

For September, popular TV host and comedian Bill Maher come add fire join di matter as e call wetin dey happun "genocide."

E tok say Boko Haram group "don kill over 100,000 pipo since 2009 and burn 18,000 churches."

Pipo wey get influence too don dey push di tori for social media.

Di Nigerian govment for Abuja don reject di claims, say "e no show wetin really dey happun."

Some key events wey happun since Trump threat.

Tinubu meet wit security chiefs and give order to end insecurity

President Bola Tinubu give marching orders to di new service chiefs make dem crush insecurity anywia inside Nigeria.

E warn dem say make dem act sharp-sharp against new threats, say "any new snake wey show, make una break im head before e grow."

Each of una wey we select get big task, because without security, every other thing no make sense."

Comment by di Chief of Defence Staff

Di Chief of Defence Staff (CDS), General Olufemi Oluyede, dismiss wetin US President Donald Trump tok say Christians dey suffer persecution for Nigeria.

E insist say di main wahala wey Nigeria dey face na terrorism, no be religion matter.

As e dey yarn wit journalists on Monday for Abuja, General Oluyede call Trump statement "misleading," say insecurity dey affect everybody both Christians and Muslims.

E tok say, "Nobodi dey persecute Christians for Nigeria. Na insecurity we dey face, especially terrorism, and e don dey worry us for long."

Di Defence Chief come add say di Nigerian Army dey focus on terrorism, banditry, and oda violent crimes, and religion no join for di operation at all.

Oluyede explain say terrorism no be only Nigeria dey face am, say e be global challenge, so we need international help to solve am.

"Many kontris dey face same wahala, so we need collective effort. Any kontri wey ready to support Nigeria, we ready to work wit dem," e add.

US Lawmakers hail Trump

Texas Senator Ted Cruz don dey campaign on top dis matter for long, and e neva stop.

E write for X say, "since 2009, over 50,000 Christians for Nigeria don die and over 18,000 churches and 2,000 Christian schools don dey destroyed."

Cruz accuse Nigerian officials say dem dey "ignore or even support di killing of Christians by Islamist jihadists."

As e dey tok for Washington on Wednesday, Senator Cruz hail President Donald Trump for bringing back Nigeria "Country of Particular Concern (CPC)" status di list wey US State Department dey use for kontris wey dey violate religious freedom.

Cruz, togeda wit congressmen Riley Moore and Tom Cole, don dey lead di campaign make US Secretary of State Marco Rubio mark Nigeria as CPC.

BBC Investigate Trump claim

BBC Disinformation Unit do investigation to really ansa if genocide dey happun for Nigeria.

BBC find say di source of di data wey, Ted Cruz and odas dey use for dia informate no dey verifiable.

For one podcast for September, Cruz bin refer to one 2023 report by di International Society for Civil Liberties and Rule of Law (InterSociety) - wey be non-govmental organisation wey dey torchlight and track human rights abuses across Nigeria.

Im office also send BBC some links to online tori on di mata. But most dem bin link back to InterSociety.

For report wey dem publish for August, wey combine previous research and updated numbers for 2025, e tok say jihadist groups for Nigeria don kill ova 100,000 Christians for di 16 years since 2009.

E also note say 60,000 "moderate Muslims" bin also die for dat time.

InterSociety no give list of sources wey make am hard to verify di full number of deaths e dey report.

Tinubu react to Trump claim for di first time

President Bola Tinubu chair di Federal Executive Council (FEC) meeting on Thursday, wia dem discuss di recent threat wey US President Donald Trump give.

For inside di meeting, Tinubu tok say e get confidence say Nigeria go "overcome" di US decision wey label am as Country of Particular Concern (CPC) and still win over di violent wahala wey dey happun for different parts of di kontri.

Tinubu describe Nigeria as one united "family," and e tok say im government go do everything wey e take to end terrorism and bring peace for di kontri.

E still beg di international community make dem support Nigeria, say, "We want our friends to help us as we increase our fight against terrorism, and we go eliminate am."

How Nigerian govment fit avoid di kasala from America

According to security expert, Dr Buhari Ubandawaki, di Nigerian govment need to improve how dem dey operate for security matter, especially for hard-to-reach areas, so dem fit flush out Boko Haram, bandits, and oda security threats.

Dr Ubandawaki tok say, "Di Nigerian Military suppose dey carry out precision attack on diz elements to boost di confidence of citizens and di international community about Nigeria ability to handle security threats."

E warn say America plan to launch attack for Nigeria "na threat to Nigeria sovereignty as a state," becos if dem allow am, e fit open door for future invasion from foreign powers.

E add say Nigeria need to reject di plan and at di same time strengthen di safety and security of her citizens.

According to am, "If Nigeria fit eliminate key security threats like Bello Turji and other known figures wey dey terrorize di country, e go boost di confidence of Nigerians and di international community for our capacity to tackle persistent insecurity."

Security analyst rating how di govment don respond

Dr Ubandawaki tok say Nigeria response neva reach wia e suppose be.

E explain say:

  • "Nigeria response no strong yet. We need mass deployment of security personnel and weapons go di affected areas to combat and eliminate these threats, so di security situation go improve."
  • Govment suppose increase security budget to buy modern, technology-based weapons like war drones and modern fighter jets wey fit do precision attacks for wia di terrorists dey hide.
  • Nigeria need better collaboration wit neighboring kontris, since most of these threats dey happun around border states.
  • "We must improve di security systems for our borders both entry and exit because na through these routes dem dey bring in weapons. If we cut off di weapon supply, e go play big role for solving di security problem for Nigeria."
  • Govment suppose improve security personnel welfare, make dia morale for combat strong well-well to face di current insecurity wey dey worry di kontri.