US resume surveillance missions for northern Nigeria afta Christmas airstrikes

Wia dis foto come from, Tasos Katopodis/Getty Images
Di United States don resume surveillance missions for Borno State, north-eastern Nigeria, following a brief pause afta di Christmas airstrikes wey bin target terrorists for northwest Nigeria.
Flight data tracker show one plane wey bin dey conduct Intelligence, Surveillance, and Reconnaissance (ISR) around Sambisa Forest, wey be known haven for Boko Haram and Islamic State West Africa Province militants.
Bifor di Christmas Day attack, di US bin conduct similar missions for Sokoto, Yobe, and di Lake Chad region.
Nigeria Foreign Minister, Yusuf Tuggar, tell di BBC say di airstrikes na joint Nigeria-US operation, wey leave room for further action.
Di renewed surveillance suggest potential follow-up strikes, dis time for di northeast.
President Trump bin order US military action against Islamic militant groups for November, as e tok say im dey protect Christians, claim wey Nigerian authorities dispute am and tok say all faiths dey targeted by di terrorists.
US intervention fit shift security dynamics for northern Nigeria, and e fit make militants do dia own back. As groups dey operate across borders, risk of regional spread dey.
Analysts doubt say di airstrikes alone fit resolve Nigeria complex security challenges.
Boko Haram insurgency since 2009 don kpai tens of thousands of pipo and displace millions for north-eastern Nigeria, despite govment efforts to end am.
Wetin di previous airstrikes achieve?
Tangaza local goverment area of Sokoto State
Authorities for Tangaza local govment area of Sokoto State, north-western Nigeria, don confam to di BBC say di US airstrikes hit di Lakurawa militant camps.
Di chairman of di local govment area, Isa Salihu Bashir, say di strikes "hit some Lakurawa terrorists camps".
E say many of di fighters die but e no fit confam di number of pipo wey kpai.
Bashir also tell di BBC say Nigerian police and military personnel don dey unable to access di affected areas becos of raging fire wey follow di strikes.
Sokoto State shares border wit Niger Republic. E say di border patrols on di Niger side report say dem see Lakurawa fighter dey run comot for di area wey airstrike hit.
Lakurawa na relatively new Islamist militant group wey don carry out attacks for parts of Sokoto and Kebbi states for north-western Nigeria, as well as across di border for Niger.
Jabo village, Sokoto
Eyewitness Umar Jabo tell di BBC say di airstrike wey hit Jabo take place on Christmas night and evribodi bin tink say na plane crash.
"Evrione bin tink say na plane. E crash for fields."
Social media images show pipo wey dey stand for one field dey feem di burning aftermath of di attack.
Umar Jabo deny say di US kill any IS fighter "Here for Jabo, we live peacefully, and conflict no dey between us and Christians."
Offa, Kwara State
Di airstrikes also hit Offa for Kwara State, northcentral Nigeria.
Tajudeen Alabi, wey be former Special Assistant to Kwara State govnor on security matas confam di incident to di BBC.
Alabi say dem hear sound three times around 9pm on 25 December.
Di former Special Assistant say di strike hit and destroy buildings for several locations but as of now dem neva report any casualty but some pipo sustain injuries.
"At least, na about five structures destroy for different locations. We see some items for one popular hotel, we dey call am Offa Central Hotel. E be like bomb."









