Guinea junta leader Gen Mamady Doumbouya win presidential election by landslide

General Mamady Doumbouya

Wia dis foto come from, EPA

Read am in 4 mins

Gen Mamady Doumbouya don win di presidential election for Guinea by a landslide afta e get most of di votes.

E get 86.7% of di vote, according to provisional results published by di election commission.

Di general bin dey hope to legalise im rule after e seize power for coup in 2021.

One civil society group wey bin dey ginger make di kontri go back civilian rule don call out di election say na "charade" as im main challengers bin dey blocked so dem no go fit to contest and as opposition candidates say di election bin get irregularities.

On Monday, di internet monitoring joinbodi NetBlock bin report say access to social media like TikTok, YouTube and Facebook bin dey restricted as Guineans bin dey wait for di results.

No official comments don comot on wetin cause restrictions but opponents see am as way wey di junta bin wan block arguments ova di results.

Di 41-year-old general victory give am a seven-year mandate. If di results dey challenged, di Supreme Court get eight days to validate dem.

General Mamady Doumbouya

Wia dis foto come from, PATRICK MEINHARDT / AFP via Getty Images

Opposition candidate Faya Millimono bin tok on Monday say di election get "systematic fraudulent practices", wey include expulsion of poll observers, ballot stuffing and intimidation.

Di ruling party and di govment neva tok pim on top di complaint.

Di tin be say wen Gen Doumbouya over throw di den-83-year-old President Alpha Condé for 2021, e bin promise say e no go run for election and go hand ova power to civilian.

E bin tok dat time say, "neither me or any member of dis transition go be candidate for anytin, As sojas, we value our word wella".

Di junta leader sha break im promise, put im name for ballot afta one new constitution wey dem implement for September allow am to run.

Eight oda candidates bin run but dem still block di main opposition parties RPG Arc en Ciel and UFDG.

But even though Gen Doumbouya dey popular wit Guinea youth, pipo don call am out for blocking opposition activities, banning protests and blocking press freedom bifor di elections.

Di general bin use similar tins to defend im coup against Condé. Tins like rampant corruption, disregard for human rights and economic mismanagement.

Guinea get di largest bauxite reserves for di world and get some of di richest iron ore. Last month, authorities bin launch di long awaited massive Simandou iron-ore mine.

But even wit all dat, World Bank say more than half di population dey leave for poverty.

Who be General Mamady Doumbouya?

No much informate dey ground about Doumbouya early life, except say e be Malinke like President Condé and e come from Guinea eastern Kankan Region.

E dey live for Forecariah, western Guinea, where e serve under di bureau of territorial surveillance (DST) and di general intelligence services.

Doumbouya reportedly attend di War College for Paris, France. E get 15 years of military experience wey include operational missions for Afghanistan, Cote d'Ivoire, Djibouti, Central African Republic and close protection for Israel, Cyprus, UK and Guinea.

Tori be say e "brilliantly complete" di operational protection specialist training for di International Security Academy for Israel, di unit commanders' training course for Senegal Infantry Application School, di staff officer training for Gabon Staff College of Libreville (EEML) and di War College for Paris.

E serve as legionary for di French army until 2018 when Conde ask am to return to Guinea to lead GFS, wey dem establish dat year.

Since 2018, plenty tori don full Guinean media wey cast doubt on Doumbouya credentials.

For October 2018, Le Guepard warn Guineans say make dem no "fall under di spell of your probable future executioner".

In August 2021, Friaguinee claim say Dombouya dey denied of French citizenship because "dem see say im conduct dey different to di values and principles" of di French legion. E also question how di colonel take get im money..

While reporting on several properties allegedly belonging to di colonel, Friaguinee as e dey report on di several properties wey allegedly belong to di colonel ask: "How dis officer, wey im monthly salary no reach five million francs [$500], take manage to build all dis buildings?"

For May, Doumbouya dey among di 25 Guinean officials wey dey singled out for EU sanctions sake of human rights abuses. Plenty rumours dey say e dey detained for Camp Dubreka for western Guinea but na only rumour.

Doumbouya also appear like say im dey against di defence ministry exercising oversight of GFS.