Nigeria cruise enta Afcon 2025 quarter final wit 4-0 over Mozambique

Ademola Lookman and Victor Osimhen dey celebrate goal against Mozambique for Afcon 2025

Wia dis foto come from, SEBASTIEN BOZON / AFP via Getty Images

Read am in 6 mins

Nigeria don book dia place for di quarter finals of di Afcon 2025 afta dem knack Mozambique 4-0 in di last 16.

Ademola Lookman finish into di top corner from Akor Adams' square pass to open di scoring in di 20th minute.

Den two goals from Victor Osimhen on each half put Nigeria in full control of di game wey shelle for Fes.

Akor Adams put im name ontop di scoring sheet afta e shoot inside di 18 yard box to score im first goal of di tournament.

Nigeria go face either Algeria or DR Congo in di quarter-final on Saturday.

Victor Osimhen dey celebrate goal

Wia dis foto come from, Abdel Majid BZIOUAT / AFP via Getty Images

Second Half

90' ADDED TIME minimum of 3 min.

88' Short pass find Raphael Onyedika but e play di ball too high.

86' SUB Ademola Lookman and Adams Akor comot for Samuel Chukwueze and Victor Onuachu.

85' Moses Simon launch hard tackle on im opponent and di referee blow for foul.

83' SUB Fisayo Dele-Bashiru replace Frank Onyeka and Raphael Onyedika enta for Wilfred Ndidi

82' SUB Ernan Siluane comot for Ivane Urrubal.

81' Nigeria dey enjoy some possession.

79' E resemble handball by Reinildo Mandava but ref say NO penalty!

76' 4 - 0 Goal! Akor Adams (Nigeria) coolly slotted the ball past the goalkeeper.

74' 18:2 – the total goal attempt statistics.

Victor Osimhen celebrate goal against Mozambique for Afcon 2025

Wia dis foto come from, SEBASTIEN BOZON / AFP via Getty Images

68' Eric Chelle prepare im first substitution. Victor Osimhen comot for Moses Simon

67' Substitution. Faisal Bangal comot for Stanley Ratifo.

65' Nanani give nice cross, but Stanley Nwabali punches di ball comot.

64' Ademola Lookman corner wey no make sense.

63' A cross into di box from Wilfred Ndidi dey cleared. Nigeria force a corner.

62' Abdou Mefire show yellow card to Faisal Bangal.

62' Substitution. Chamito replace Witi.

58' Bruno Langa do well to dispossess di attacker wit a slide tackle

53' Nanani pull im opponent jersey and ref Abdou Mefire blow whistle for a foul.

52' Faisal Bangal shoot but defenders clear am.

51' Bright Osayi-Samuel receives better pass on di edge of di box and bend im effort to di left post.

50' Calvin Bassey makes rough challenge and di referee blow for foul.

47' 3 - 0 Goal! Victor Osimhen make am three for Nigeria wit anoda pass from Lookman,

46' SUB Diogo Calila comot for Nanani (Mozambique).

46' SUB Domingues comot for Manuel Kambala (Mozambique).

Nigeria 2-0 Mozambique

45': Second Half don start

Ademola Lookman

Wia dis foto come from, Abdel Majid BZIOUAT / AFP via Getty Images

First Half

45+5' Referee Abdou Mefire don end di first half.

45+3' YELLOW CARD for Frank Onyeka afta e bring down im opponent.

45' 3 min. of stoppage-time

44' Akor Adams (Nigeria) creates a yard of space for himself and tries an effort from the edge of the box, but it goes just wide of the left post.

42' Geny Catamo be like e wan escape wit di ball, but Nigerian player clear di ball comot.

41' Akor Adams chop warning for a foul.

38' YELLOW CARD Wilfred Ndidi gatz dey careful for di rest of di match.

37' Alex Iwobi send a weak shot high over di bar from di edge of di box.

35' OFFSIDE for Fisal Bangal of Mozambique.

34' 65:35 – the ratio of ball possession.

29' Ernan Siluane dey move okay again afta di injury scare.

25' 2 - 0 : Goal! Ademola Lookman put cross into the box and find Victor Osimhen wey make am 2-0 to Super Eagles.

23' Total attempts – 5:0.

20' 1 - 0 Goal! Ademola Lookman puts di ball inside net!

18' Di Nigeria players dey exchange fine passes and dey wait for opportunity to start attack.

Geny Catamo wear Mozambique nation jersey wey be red shirt and black shorts wey get black design and dem write number 10 wit white. Raphael Onyedika wear Nigeria all-white national jersey wey get green design, dem write number 18 wit black. Both players dey in action wit stadium crowd for di background.

Wia dis foto come from, FRANCK FIFE / AFP via Getty Images/ Issam Zerrok / Hans Lucas / AFP via Getty Images)

Wetin we call dis foto, Geny Catamo, Mozambique/Raphael Onyedika Nwadike, Nigeria

16' Domingues (Mozambique) deliver lovely cross into di penalty area, Bassey clear am.

13' Victor Osimhen find himself free inside di box and shoot, but defenders block im effort.

10' Bruno Onyemaechi cross di ball into di box from di free kick, but di defence clear di danger.

08' Ademola Lookman try to find Victor Osimhen through ball from di corner of di box, but di defence dey alert to stop di danger and clearmdi ball.

07' A cross from a corner kick by Nigeria too strong and di ball go out of play.

03' VAR cancel Osimhen goal.. NO GOAL for Nigeria due to offside in di build-up play.

02' Bright Osayi-Samuel sends beta cross into di area, but Ernan Siluane intercept di ball.

Nigeria 0-0 Mozambique

Referee na Abdou Mefire

01': KICK OFF

Nigeria vs Mozambique starting lineup

Nigeria starting lineup: Stanley Nwabali, Osayi-Samuel, Semi Ajayi, Clavin Bassey, Bruno Onyemaechi, Frank Onyeka, Wilred Ndidi, Alex Iwobi, Ademola Lookman, Victor Osimhen, Akor Adams

Mozambique Starting Lineup: Eman, Diogo Calila, Bruno Langa, Reinildo Mandava, Edson Mexer, Faisal Bangal, Witiness Quembo, Domingues, Geny Catamo, Alfons Amade, Ricardo Guimaraes

Wetin di coaches tok

Mozambique Head coach Chiquinho Conde say Nigeria na big name for African football but insists say im team don prepare well-well to surprise Nigeria for di tournament.

"We no go fit say we dey happy to face Nigeria because like say we win, e for remove us from dia path or maybe if we bin finish second or third. Nigeria na strong team and nobody go like to play against dem."

"But na di task wey we get for hand and we go face di game like di way we dey do against di top teams for Africa. We go show dem respect but we go play without fear."

Super Eagles coach, Eric Chelle tok say im dey under pressure to win for Nigeria against Mozambique.

Im no wan compare dia current situation wit di bad performance Nigeria bin get for di 2021 edition.

"Since I start dis job, I dey feel a lot of pressure. Dis no be about di NFF. Na about di official, di group, and me," im tok.

"Now we dey tink about di game against Mozambique, and we definitely want to win di game. To ansa your question, yeah, we dey under pressure," Chelle add.