Osimhen and Adams goals comot Algeria for Afcon 2025 as Nigeria go face Morocco

Nigeria go meet Morocco for di semi-final of Afcon 2025 afta dem beat Algeria for di quarter-final.

Summary

  • Nigeria go meet Morocco for di semi-final of Afcon 2025 afta dem beat Algeria for di quarter-final
  • Nigeria dominate di match from start to finish, but Algeria no still make di game easy for di Super Eagles
  • First half end for goalless draw afta Nigeria and Algeria try dia luck but goal no come
  • Victor Osimhen score Nigeria first goal immediately second half start for di 47th minute
  • Adams Akor score ten minutes later wit Victor Osimhen assist for di 57th minute
  • As e stand now, Algeria and Nigeria don meet for 23 times, including both competitive and friendly matches
  • Algeria win 10 times, while Nigeria also win 10 times. Three games bin end for draw

Live Coverage

Tunde Ososanya x Tamara Ebiwei

  1. Nigeria go meet Morocco for Afcon 2025 semi-final

    Nigeria go jam host nation Morocco for di semi-final of di Afcon 2025 afta dem sama Algeria 2-0 for Marrakech.

    Victor Osimhen and Akor Adams bin dey on target as di Super Eagles bin firmly dey in control in di first half.

    Osimhen bin break di deadlock for di Super Eagles just two minutes into di second half, as e head Bruno Onyemaechi deep cross from di left down and back across goal for im fourth goal at dis finals.

  2. FULL-TIME, Nigeria 2-0 Algeria

    90+ 8

    Referee don blow whistle , match don end.

  3. 90+6 Algeria dey wit di ball for di last few seconds but Nigeria no give d space.

  4. GREAT SAVE!, Nwabali of Nigeria run come out to save di ball.

    90+5 Algeria player collect ball from Nigeria player wey do back pass, e use di ball run go Nigeria goal area con fire shot.

  5. 90+2 Nigeria dey hold ball dem no wan give Algeria small chance. Dem Dey play short-short passes.

  6. 90’ Referee add six minutes.

  7. 90’ Algeria fire shot but Nigeria goalkeeper dive catch do ball without stress.

  8. SUBSTITUTION, Double substitution for Nigeria

    87’ Adams Alor don comot , Chinedu Awaziem don enta.

    Lookman don comot too and Dele- Bashir enta.

  9. YELLOW CARD, Nigeria goalkeeper Nwabali collected card

    85’ Nwabali collect card for wasting time with di ball.

  10. 84’ Algeria get chance but dem ballon di ball!!!

  11. Missed chance!

    Osimhen bin get chance to shoot and score but e pass di ball to Akor wey miss di target sale of too many defenders.

  12. 81’ Algeria player ballon di ball as e fire shit from far.

  13. 79’ Nigeria get chance to score but Algeria defenders clear am. E land for Lookman leg e try to shoot but e space e pass di ball back.

  14. YELLOW CARD, Nigeria collect yellow card

    67’ Wilfred Ndidi Nigeria captain bin collect card for rough tackle.

  15. YELLOW CARD, Algeria collect dia fifth yellow card

    76’ Boudaoui collect yellow card afta e push Lookman of Nigeria from back.

  16. 74’ Algeria Dey play like say dem just wake up from sleep, dem just dey run around Dey try to get di ball from Nigeria.

  17. 73’ Alex Iwobi of Nigeria make beta run wot do ball e fire shot but referee blow whistle for foul.

  18. YELLOW CARD, Algeria don collect dia fourth yellow card

    Hadj Moussa wey just enta collect yellow card afta e foul Osato.

  19. 68’ Algeria fire shot for Nigeria goal area, goalkeeper punch di ball wey rebound come land for Algeria leg , dem fire am again but Nigeria defenders clear clear di ball.

  20. 66’ Wilfred Ndidi of Nigeria don get injury o, dem don carry am comot from field.