Senegal vs Egypt 2025 Afcon semi-final match preview

Wia dis foto come from, ULRIK PEDERSON/NURPHOTO/VISIONHAUS VIA GETTY IMAGES
Record Afcon title winners Egypt (seven times) dey jam wit Senegal (dem win di title only once) for di first of two semifinal games for di tournament.
Di stakes dey high as both teams perform well so far – wey dem sama oda top teams to reach di last four.
Di Pharaohs of Egypt comot defending champions Cote D'Ivoire 3-2 for di quarterfinal while Senegal comot 10-man Mali 1-0.
For di oda semifinal game wey go happun later at 8 PM GMT (9PM WAT), hosts Morocco dey take on Nigeria.
Football fans dey expect seminal game wey go serve everitin – emotions, fun, pressure, anxiety, drama and many more as some of di world's best players go face each oda.
Senegal coach Pape Thiaw say his team dey prepare for dis game wit all dia energy and focus.
"We sabi say we dey face strong Egyptian team wit plenty stars, wey dem be tactically disciplined," but we go do our best.
"We go approach dis game wit respect but also wit real ambition to win and reach di final," coach Thiaw tok Caf media.
E also explain say im team go stick to dia own philosophy sake of dem sabi say dat na di key to make di difference for dis game.
Just like Thiaw, di Egypt coach Hossam Hassan also dey confident say his team fit reach di final.
But e sabi too say Senegal neva be small team.
"We dey approach dis game wit great respect for our opponent but also we dey prepare well well."
"We dey mentally ready, we sabi di team we dey play wit well well; but we also sabi our strengths. We get our strategy like oda teams too get dia own, but we go prepare wit our own," coach Hossam Hassam tok.

Wia dis foto come from, AYMAN AREF/NURPHOTO VIA GETTY IMAGES
Road to di semifinal
Senegal don play all dia five games for Tangier – dem win four of dia five games to reach di semis.
Dem beat Botswana 3-0, wey dem draw 1-1 wit DR Congo bifor dem defeat Benin 3-0 and den anoda 3-1 against Sudan for di R16.
Di Teranga Lions also beat Mali 1-0 for di quarterfinal.
Dem score a total of 11 goals in di process when compared to di nine goals from Egypt.
Di Pharaohs first beat Zimbabwe 2-1, wey dem sama South Africa 1-0 and draw 0-0 wit Angola for di group stage.
Dem later beat Benin 3-1 wey dem also beat defending champions Cote D'ivoire 3-2 for di quarterfinal to reach di semis.
Both teams get good attacking power wey dem go jam to see who go come on top and reach di final.
Senegal v Egypt Head-to-head

Wia dis foto come from, AYMAN AREF/NURPHOTO VIA GETTY IMAGES
Across 15 games bifor now, Egypt dey lead wit seven wins, Senegal get five wins wey di three oda games end for draw.
For di Afcon, dem meet each oda five times - wey dem all win two games each and one draw.
Dis dey show say dis game na ogbonge football game.
Dia most recent meeting happun for di 2021 Afcon final for Yaoundé when Senegal beat dem for penalties to win dia first ever trophy.
Dat defeat pain di Pharaohs well well as dem fail yet again to win dia eighth title wey dem dey pursue since 2010 when dem win dia last Afcon.
Dem lose di final for 2017 also.
Many pipo tink say Egypt dey enta dis game wit revenge and unfinished business from 2021 – odas tink say Senegal wan show say dem too be big boys for Africa.
Team news and key players for dis game
Liverpool star Mohammed Salah dey chase his first ever Afcon title – so far he don lead di Pharaohs well for dis competition wit four goals - altogeda, di Egyptian captain get 11 Afcon goals.
But for di five times he don face di Teranga Lions, Salah neva score against dem; he go hope say dis be di time to break dat bad luck.
His former Liverpool teammate Sadio Mane also face Egypt five times – he score one goal wey he win three times, wit one defeat and one draw.
Mane don create di joint-most chances for dis tournament (14) same as Nigerian star Ademola Lookman; wey Salah dey follow dem wit 12.
Salah and Mane go be key players for dia teams when dey face each oda - but no be dem alone.
Manchester City forward Omar Marmoush (two goals so far) and Emam Ashour (grab two assists for di quarterfinal v Cote D'ivoire) wey dey play for Al Ahly go be crucial for di Egyptians.
Senegal so far scatter dia goals among diaserf – so even though none of dem get lead di goal chart, Pape Gueye, Nicolas Jackson, Cherif Ndiaye all get two goals each.
Di Teranga Lions go hope any of dia top players go deliver di goals on Wednesday including Sadio Mane.
All dey set for dis game wey go happun for Tangier at 5PM GMT (6PM WAT).
Make una join us at dat time for live text commentary make we find out who go reach di final of di 2025 Afcon for Morocco.










