Kylie Jenner fit become di youngest 'self-made' billionaire - Forbes Magazine

Kylie Jenner

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, kylie Jenner welcome her first pikin dis year
Read am in 1 mins

Kylie Jenner di youngest of di Kardashian-Jenner family for America dey on di road to become di 'youngest ever self-made billionaire' for di world.

Forbes magazine dey estimate say Kylie worth $900m, dis one mean say she no only be di richest for her family, but say she dust pipo like JK Rowling, Adele and her sister Kim Kardashian.

Di current holder na Mark Zuckerberg wey hold di title at di age of 23 wit $1bn.

Jenner tok about am ontop Instagram.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

While $100m of Kylie money come from endorsement deals from Puma, PacSun clothing, diet teas and oda slimming products plus her appearance from 2 reality show Keeping up with the Kardashians and Life of Kylie.

Kylie Jenner

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kylie say she start her cosmetic business for inside her mama garage

Di remaining $800m na from her Kylie Cosmetics di company wey Jenner launch 2 years ago.

Since Jenner start her company, dem don sell make-up worth of $630m, she dey also use her social media presence sell her market, she get 110 million followers for Instagram alone.

Jenner get power ontop social media sotey wen she she post say Snapchat don become boring to her, di company loss 6% of dia value wey wey be $1.3bn within one day.