Hailey Baldwin: 'We bin tink say Justin Bieber go engage Selena Gomez' - Fans

Justin Beiber and Hailey Baldwin.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Beiber and Hailey begin friend each oda afta im breakup wit Selena
Read am in 1 mins

Ogbonge Canadian musician wey dey melt girls hearts, Justin Bieber don engage im girlfriend Hailey Baldwin.

Di tori no too totori some fans wey dey hope say Bieber go engage im long-time girlfriend Selena Gomez.

Bieber and Gomez bin breakup but pipo think say dem go come back together afta di couple reunite last year.

Bieber and Selena bin start dia friendship afta Selena do kidney transplant. Bieber see am say im need to dey there for Selena as she dey sick.

Pictures of di two of dem togeda even spread for internet and e come make fans get high hope say dem don begin friend each-oda again.

E no dey shocking say some fans no happy as Bieber engage Baldwin, im model babe wey im begin friend afta im and Selena breakup.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

67% of di Twitter users wey take dis poll dey hope say Beiber and Selena go still come back together.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Who be Hailey Baldwin?

Hailey Baldwin

Wia dis foto come from, Hailey baldwin/instagram

Wetin we call dis foto, Hailey don model for top brands like Tommy Hilfiger

Hailey Rhode Baldwin wey be her full name na 22 year-old model for America. She don model for top brands like Vogue, Ralph Lauren and Tommy Hilfiger. She don also show face for music videos and television shows.

Hailey na di pikin of US actor and producer, Stephen Baldwin. She also be di niece of top US actor, Alec Baldwin.