Selena Gomez: "My friend donate kidney give me"

Wia dis foto come from, Instagram/Selena Gomez
Selena Gomez don open up about one kidney operation wey she do few months ago on top lupus disease.
For Instagram, di singer talk say na her friend, Francia Raisa, wey donate kidney give am and na dis operation don make her face scarce even though she get new album for market.
Selena Gomez also use Instagram appreciate her friend, actress Francia Raisa.
"My mouth no get di kind thank you l wan tell beautiful friend Francia Raisa.''
"She give me di biggest gift, and na sacrifice she do as she donate kidney give me. I don get big blessing. I love you plenty sis."

Wia dis foto come from, Instagram/Selena Gomez
Francia Raisa also talk her own for Instagram.
''E sweet me well-well say God fit trust me with something wey go save person life and change my own too as l dey do am."

Wia dis foto come from, Instagram/Selena Gomez
Selena Gomez release di first song for her album wey no get name for March this year but she no promote am because of di kidney operation.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di first time she comot go event after she don recover for di surgery na last Friday night with her boyfriend The Weeknd for New York.

Wia dis foto come from, Getty Images
Last year, she comot herself for social media on top her health mata wey include panic attack, anxiety and depression.
Di 25-year-old say she get mental health problem wey be part of di lupus sickness wey start last year.

Wia dis foto come from, Getty Images
Lupus dey affect di immune system of person body.
Immune system na di things inside person body wey dey fight disease wey wan enter.
People wey get di disease fit dey tire too much, get plenty rashes especially for face and for hand, pain for joint and dem body fit swell.











