Kylie Jenner don born baby girl

Kylie Jenner with her pickin papa, Travis Scott for basket ball game

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Rumours bin also dey say she break up wit di pickin papa, Travis Scott but im dey di delivery room when she born
Read am in 1 mins

Kylie Jenner wey be 20 year old business woman wey dey sell makeup things, don born her first pickin with her US rapper boyfriend, Travis Scott.

Dis na as for February 4, she release official video of di birth of her daughter wey she born for di beginning of di month.

For many months rumours don dey go round about whether he get belle after her social media content bin come down well-well.

She dey part of di ten people for Instagram wey get di most followers.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

She write for her social media page why she bin hide di pregnancy from di world.

Say she bin want dis experience to be her own so she go fit enjoy am.

Di pickin, baby girl comot belle on 1 February 2018 and bin weigh 8 pounds and 9 ounces.

Skip YouTube post
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post

Kylie also bring out official video on top di whole pregnancy and na already number one or trending video for YouTube.