Building collapse, flood and traffic - Lagos residents count dia loss afta early mor-mor continuous rain shut down parts of di state

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Lagos state emergency agency don warn say make pipo avoid travels wey no dey important during dis period of heavy rain fall and flash flood.
Di advisory na sake of one heavy rainfall wey bin start around early mor-mor 3:00am on Wednesday wey cause gbege across di state.
Oga of di agency, Olufemi Oke-Osanyintolu for statement tok say di agency and oda key responders dey on high alert.
Emergency workers rescue seven pipo afta two storey building collapse for Mushin area of di Southwest state.
Di response team say dem ansa one call for help around 9:37am for No 12 Cameroun street Mushin wia dem rescue three females and four males wey now dey hospital for treatment.
Oke-Osanyintolu say Lasema search and rescue team say afta dem search di rubble fit confam say no victim still dey under di building.
For di statement dem say, di building bin dey marked for structural and integrity testing by Lagos State Building Control Agency and Lagos State Material Testing Laboratory.
E tok say make pipo stay calm as di flood already don begin disappear.
End of Di one wey oda users dey read well well

Taiwo Ajisafe wey dey live for Iyana oworo area of Lagos na one of di pipo wey di Wednesday continuous downpour and floods affect.
She say she bin no fit go work sake of di heavy rain and serious floods for her area.
Taiwo tok say she bin return to her house so she go fit protect her three pikin dem from flooding for her house wey dey witness constant flooding afta heavy down pour.
Many workers across di state bin hook for bus stop as no vehicles dey road to commute dem to dia destination sake of how floods take over some roads.
Iyana-Oworo, Olopo Meji areas wey be di main entry point for 3rd mainland bridge bin dey seriously flooded, e cause heavy traffic down to Alapere.
Some road users tell BBC Pidgin say dem bin spend over four hours from Alapere to di domot of di 3rd mainland bridge.
Many pipo enta social media platforms to express dia worry and how di rain take affect dem for dia area.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Two hours na wetin e take Mary-Jane Ukeme house to sink under water following the flooding for di Ipaja area of Lagos state.
She tell BBC Pidgin say, her motor bin sink under di water wey full her compound and water find im way enta di fuel tank for inside her motor.
Apart from need to clean inside her house wey water enter, di 51 year old widow also face bill of 150,000 naira to fix di damage wey di rain wey enta inside her motor, come mix wit her fuel cause.
She say, "na so 35k fuel wey my pikin help me buy just di oda day just waste like dat o. But sha we thank God for life."

States wey go witness heavy rains
Nigerian Meteorological Agency (NiMet) bin don predict say 13 states of di kontri go witness heavy rainfall for for days wey end di month of June.
Di agency, say di state wey dey affected fit witness flash floods for roads, bridges and low-lying areas wey fit cause traffic.
Di warning na sake of Madden-Jullian Oscillation wey sabi pipo say go dey strong for West Africa.
Niger, Plateau, Benue, Kaduna, Taraba, Delta, Imo, Cross River, Akwa Ibom, Rivers
Bayelsa, Ekiti and Osun states
Below na di states wey Nimet fit witness light to heavy rains
Lagos, Edo, Kano, Borno, Zamfara, Gombe, Adamawa, Kogi, Kwara, Nasarawa, Ogun
Oyo; Ondo, Enugu and Ebonyi













