Goment react afta ocean rush displace many villagers, destroy ova 200 houses for Bayelsa
Niger Delta Development Commission (NDDC), say dem go deploy modern technology to tackle di erosion palava for Sangana community, for Brass Local Goment Area of Bayelsa State.
Dis dey follow di recent devastating ocean surge for di community wey don displace many villagers and destroy ova 200 houses for Bayelsa State.
NDDC Managing Director, Dr Samuel Ogbuku as e go inspect di eroded shoreline for Sangana say di intervention of di Commission na response to President Bola Tinubu directive for urgent action to reduce di sufferings of di pipo.
E say President Tinubu na caring leader wey get di interest of di pipo and na im make e call dem to action for wetin dem consider to be one of di worst ecological disasters for di Niger Delta region.
E visit di community for on-di-spot assessment of di level of devastation and donate relief materials for di immediate needs of di pipo wey dey displaced by di ocean surge.

Wia dis foto come from, John Sango Rabbi
“Before your letter of appeal arrive our head office in Port Harcourt, di ocean surge in Sagana bin already dey publicized in di media, and di President of di Federal Republic of Nigeria see am and direct say we gatz come and see wetin dey happun for Sangana and give am feedback."
Di NDDC MD Ogbuku note say “dem bin don award di contract for shore protection for di community bifor, but dem go review am again.
"Di whole idea for NDDC be say we dey looking at new technology like Geotube system. Di system also dey used in rebuilding and reclaiming di land naturally."
E also call on di multinational oil Company wey dey operate for di area to join hand with dem to address di persistent ocean surge for di communities around di area as NDDC no fit do am alone.
Chairman of Sangana Council of Traditional Rulers, King Moses Theophilus Kenibara VII, Amadabo of Moko-Ama Sangana, tank President Tinubu for di love e show di pipo of Sangana community and assure say di pipo go continue to maintain peace and cooperate wit goment for di development of di kontri.

Wia dis foto come from, NDDC
Most of di displaced pipo dey take shelter for di community primary school but di rising flood go soon go pursue dem comot from dia as di water dey close to di school.
One indigene of di commujity, John Sango Rabbi tell BBC Pidgin say di community don lose over 800 metres of land sake of di ocean surge and many more houses and lands go sink into di Atlantic Ocean if goment no do anytin about am.
"We dey live in fear for Sanagana now," na so anoda indigene Rebecca Dennis-Opubo anoda describe di situation for Sangana.
"We don dey suffer erosion from di Atlantic ocean for a very long time but we dey for serious danger now becos our community dey on di verge of being washed away becos water from di ocean don pass and wash away di embankment wey goment do, enta and flood di community.
"Even my papa house dey affected becos dis fit be di last time wey we go see our papa house.
"Many families dey displaced and dem dey stay wit dia brothers and sisters but even dem too dey under threat becos di flood fit sack dem anytime. Our cry na who go come help us?" Dennis-Opubo ask.
Di community bin call on goment to come make shore protection and sea embankment to protect di community bifor dem sink inside di Atlantic Ocean.

Wia dis foto come from, NDDC




