Ogbonge Islamic scholar Muyideen Bello die at di age of 84

Wia dis foto come from, BABAJIDE SANWO-OLU/FACEBOOK
Di Muslim community dey currently mourn di death of one of im most respected figures, Alhaji Muyideen Ajani Bello.
Na anoda ogbonge Islamic scholar, Alfa Aribidesi of At-Tawdeeh Islamic Da'awah make di announcement of im death on Friday morning.
Alhaji Bello wey dem born for 1940 for Ibadan, dey respected for im ogbonge teachings and dedication to Islamic scholarship.
Islamic scholar Alhaji Taofeeq Akeugbagold tell BBC say na on Friday morning Alhaji Bello die for im house.
Dem go bury di ogbonge scholar on Friday evening according to Islamic religious rites.
For im Facebook page, Akeugbagold say, "Today na one of my saddest days ! My father and mentor, don return to im creator. SULTONUL WAHIZEEN of Yorubaland Sheikh muhyideen AJANI BELLO, may Allah dey pleased wit your soul. Aljannah fridaos for you .
"Our heart dey full of grief and our eyes full of tears but we go say notin but wetin go please our Creator di sole commander of life and death – ALLAH."
'E go dey remembered for im great sacrifice' - Sanwo-Olu
Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu don send im condolences to di family of di late scholar.
Govnor Sanwo-Olu say di late Sheik go "dey remembered for im great sacrifice and commitment to di propagation of Islam, honesty, dignity, harmony and moral development of our pipo"..
"I pray make Allah grant di repose of im soul and grant im family and loved ones di fortitude to bear di irreparable loss."
Who be Alhaji Muyideen Bello
Sheik Muyideen Ajani Bello na scholar of Islamic teachings and knowledge.
Dem born am for Ibadan, di Oyo State capital.
Tori be say im bin live for north for most of im life bifor im settle for Ibadan about 20 years ago.
According to reports, na ten years old Bello bin dey wen im begin to teach.
Im papa, wey bin dey veri popular dat time teach am Islamic studies.
Bello bin work as teacher for Ansa-ru-deen College for Wani Saki, Oyo State.
E also work as teacher for grammar school for Abeokuta, wia im bin teach Mathematics and Biology.










