Military react to bandits new strategy of planting landmines for road for Zamfara

Foto of bandits

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Residents of Dansadau and Yargaladima wey dey for Maru local goment for Zamfara state in northern Nigeria dey live in fear since bandits begin dey use land mines for road.

Dem dey use dis strategy to stop authorities from responding to emergencies each time dem attack any village.

Dis na di second time wey di landmine explode wit civilians for Dansadau area wey kill atleast seven pipo in four days.

According to reports from Zamfara di bandits dey use roads wey don spoil and plant dia landmines as traps for Nigerian military.

Tok tok persin for Nigerian military Major-General Edward Buba tok say dem dey aware of di 1 December attack.

E confam say di terrorists plant IED for Dansadau route for dia troops, and e kill one commercial driver.

Zamfara state dey among di states for Northern Nigeria wey dey experience insurgency.

Di terrorists dem don carry out many deadly attacks wey don kill civilians and security operatives.

One eyewitness wey wan hide im name sake of security mata confam dis disturbing tori to BBC - e say di second landmine wey explode on Wednesday kill at least six pipo and wunjure eight odas.

“Na one driver wit passengers wey come from Magami. E hit di landmine for one culvert wey spoil for di road and e make di moto to explode”

“Dis na di second time dem plant landmines for our area and we dey suspect say na di same gunmen group wey attack Unguwar Galadima area plant di explosion” im tok.

Di first of incident happun on 1 December 2024, wia one land mine explode wit one commercial car di time wey di driver dey try dey go carry oda passengers from Gusau.

Anoda resident for Dansadau village tell BBC say na one bandit kingpin wey pipo sabi as Dogo Gide na im dey plant land mines, and e dey do am to force di residents to dey wit am for money.

“For evri wia wey bandits activity dey between Gusau and Dansadau, wen you hear say dem plant land mines e mean say na Dogo Gide wey dey try to force dos residents for di area to sit wit am”.

Di source say “Di bomb explode wit one driver wey drop passengers for Dansadau as e dey im way to go get oda passengers from Gusau”

“Dem plant di land mine as trap for securities to cut dem from getting for di places dem dey attack”.

E add say since di incident dem get report say di bandits dey don do meeting on how dem go attack Yargaladima village wit new method.

Anoda source tok say dem bin dey hear stories say bandits dem bin dey plan to dey use explosion materials in dia attacks afta dem realise say dem fit no attack any village wey fit get help from securities or oda pipo around di area.

“We bin dey hear stories say bandits dey create some kain explosion device wey we no fit confirm since dem neva use am before.”

E add say “Di main reason why dem start dey use explosion device be say dem realise dem no fit attack us for fair fight, na im be reason dem dey try to cut ways wey fit bring help for us.”

Wetin e mean for Nigeran national security

One expert tok say dis new way wey bandits for Northwestern Nigeria dey use fit turn big threat to national security and di security dem sef wey dey work for dia.

Dr Yahuza Getso, wey be security expert tell BBC say dis mata show say three main problems dey, including how Nigerian security dey track or gada informate.

Dr Getso still tok say di main reason for dis problem na how di security no dey gada informate or track di pipo wey suppose get di explosives wey dem dey use break stones.

“Dis one dey show say authorities no dey put eyes for explosive devices (IEDs) well and dem no dey track who suppose get dem or even get dem.”

“Secondly, e show say pipo dey work wit bandits to get explosives from di public,” im tok.

“E good make dem dey monitor di pipo wey get explosives and punish anybodi wey dem catch dey sell am give bandits, same way dem go punish di bandits if dem catch dem.” Dr Getso tok.

“Need dey for security to get new modern technology wey fit help dem do dia work well, wey go also help dem get more infomate of di bandits activities” im tok.

Tok tok persin for Nigerian military Major-General Edward Buba tok say "We dey aware say di terrorists wey dey loyal to Dogo Gide dey use IED to deny our troops movement, and e kill one commercial moto driver for Dansadau area of Maru LGA of Zamfara State."

"Di incident na tragic one and e show di wicked and heartless nature of di terrorist" oga Buba tok.

E add say dem get anoda report of IED on 4 December 2024, say terrorist plant explosion device for di same local goment.

"About 0900hrs on 04 Dec 2024 di same group of terrorist plant IED around Mailamba to Yar Tashar Sahabi village wey dey along Dansadau route under Marabu District of Maru LGA in Zamfara State" im tok.

In dia effort to stop dis kain incident to happun in di future oga Buba say measures dey in place as di military begin dey try to locate and destroy di terrorists wey dey do dis kain act.

"Di military don begin operations wey go locate and destroy di terrorist wey dey behind di act."

Buba add say "Explosive team don bin deploy for di area to scan di route and remove or destroy any explosives wey di terror group plant."