Family bury actor Charles Olumo Agbako wey die at 101

Man inside di ground holding plank wit pipo standing around him and face of a man wit beards
Wetin we call dis foto, Burial arrangement don begin for Late Charles Olumo
Read am in 3 mins

Family of ogbonge actor Abdulsalam Ishola wey pipo sabi as Charles Olumo Agbako don bury am afta im death on Thursday, 31 October, at di age of of 101.

Di President of di Theatre Arts and Motion Pictures Practitioners Association of Nigeria (TAMPAN), Bolaji Amusan popularly known as Mr Latin bin announce di death for one post on im Instagram page.

Top celebrities and Nollywood pipo don begin dey visit di house of di late actor to pay dia respect to am.

Ogbonge Nollywood actress Idowu Phillips popularly known as Mama Rainbow wit oda stars dey di house of di deceased to sympathise wit di family.

Charles Olumo na ogbonge actor wey dey popular for di Yoruba Nollywood movie industry for Nigeria.

According to tori wey reach us, Charles Olumo bin die on Thursday morning 31 October 2024 afta e say im wan go rest.

One of di pikin of di deceased, Motunrayo Iwa wey also confam, say her papa don die, say di burial arrangement go begin dis evening.

For 2022, late Charles Olumo bin follow BBC tok on di kain sickness wey dey trouble am.

Who be Charles Olumo

Charles Olumo Agbako sitting on a chair

Im papa and mama name am Abdulsalam Ishola but for di movie industry sabi am as 'Charles Olumo Agbako'.

For one interview wit di BBC, Charles Olumo say e get di name 'Agbako' sake of how e dey important to get nickname for di acting industry. E say na why im give imsef dat name.

'Agbako' na name wey mean 'fear', e say na why im choose dat name.

Dem born Charles Olumo for 1923 and e die for 2024 at di age of 101 years.

Im join di movie industry for ova 60 years and e make impact and collect awards.

E dey known for im way of using di Yoruba language to make incantations and proverbs.

How Nollywood pay tributes

Ogbonge movie producer and actor Kunle Afod post im own condolence to celebrate di kain good life wey Charles Olumo don live on earth.

"Good night pa Charles Olumo (baba Agbako ). The oldest actor 101 years."

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post