'I no dey happy' - Funke Akindele clear tori wey say she no help Adejumoke Aderounmu wen she dey alive

Nollywood actress Funke Akindele and late Jumoke Aderounmu

Wia dis foto come from, Funke Akindele/Instagram, Jumoke Aderounmu/Facebook

Popular Nollywood actress Funke Akindele don react to accuse say she no help late Jumoke Aderounmu wen her family bin reach out to her for help wen di actress bin sick.

For one Instagram live session on Tuesday 9 April, di actress say she bin no get idea say Jumoke bin dey sick.

She say she for quiet and no respond to di allegation, but she dey forced to respond afta she see one comment on her page from one user wey tok say, “May you bury your children”.

Jumoke wey become popular afta she feature for Jenifa’s Diary, one television series wey Funke Akindele produce, die on 6 April at di age of 40.

Di deceased brother, Adeola Aderounmu, bin confam her death on im Insta story and many Nollywood actors including Ms Akindele express dia condolence and tok sorry to di family under im post.

However, Funke message no go down well wit di deceased brother as e claim say make Funke dey show fake love becos she ignore di actress wen she dey alive.

Akindele bin comment say “Sad!!!! @jideawobona I bin still ask about her. Omg. May her soul rest in peace.”

In response to di comment, di late actress brother, for series of posts on im Instagram story call out Funke Akindele. “You wey dem call tire, wey you no turn up, she even send Pascal to you, you still no reach out. Why di eye service now wen she don kpai?" E comment.

Most of im Insta story comment paint di popular actress as bad pesin wey no dey help dia colleagues but dey show eye service for public.

Dis im post bin set Funke up for dragging as some pipo for social media begin accuse her say she no dey support her colleagues - dem accuse her of eye-service, among odas. But di comment wey pain her well-well na di one wey pesin tok say she go bury her children.

Dis comment make Ms Akindele come out to clear di accusations against her.

Jumoke Aderounmu brother response to Funke Akindele condolence message

Wia dis foto come from, Adeola Aderounmu/Insta story

Jumoke Aderounmu brother response to Funke Akindele condolence message

Wia dis foto come from, Adeola Aderounmu/Insta story

I dey veri unhappy - Funke Akindele

Funke Akindele for Instagram video break down in tears as she tok about late Jumoke Aderounmu, how dem meet and all her effort to keep in touch wit her.

For di about eight minute Instagram live she do, di popular actress say di reason she do di video na becos e concern losing a family member and to clear up accuse against her.

“I gatz do dis becos e gatz do wit sombodi life. I dey so unhappy becos personally, you no know wetin I dey go through. I meet di late Jumoke years ago as an actress, I give her some roles, she feature for Jenifa’s Diary and Industreet and na im be dat. She act her role, get paid and she comot.”

“One day, out of di blues, I ask Jide Awobona (fellow Jenifa’s Diary actor) wia Jumoke dey, make una call her. I later ask, how far, you call Jumoke, e say im call her and she say make dem call her wen work dey, I say okay we go call her wen work dey but afta Tribe of Judah, I neva do any movie.” she tok for di video.

On di news of Jumoke death, she say she reach out to di brother but e no reply her message.

Funke Akindele condolence message to Adeola Aderounmu on di news of Jumoke's death

Wia dis foto come from, Funke Akindele/Insta story

Ms Akindele add say she also get her own issues.

I work hard, ‘round di clock. Pipo go say ‘Ooh she no dey support her colleagues. She no dey attend events.’ I dey live for Amen Estate, Eleko. Dat na wia my studio dey. Before I drive go Lekki or Ikoyi for event,” di event go don end.

“I no dey beef any filmmaker. I face my tin. Di record I don break na by di grace of God. No forget say I get my own trying moments too. I bin dey depressed too. Remember COVID mata, I lose my mama, Politics? Pipo yab me. Marriage, remember? Sombodi kon say you go lose your children. E dey too much.” Ms Akindele tok for di video.

Who be Jumoke Aderounmu

Adejumoke Aderounmu

Wia dis foto come from, Adejumoke Aderounmu/Instagram

Adeola Aderounmu, brother to Jumoke Aderounmu confam her death on one post for im Instagram story.

E post say “You dey for beta place now my sister”.

Jumoke wey pipo sabi well-well as Esther sake of her role for one popular television series Jenifa’s Diary die on 6 April at di age of 40.

Di cause of her death neva dey known. However, according to di family member post, dem don hold one funeral service for Jumoke for Owu Baptist Church, Totoro area of Abeokuta for Ogun State.

Di actress gain popularity for 2016 afta she feature for Jenifa’s Diary.

Bifor den, she bin work as on-air personality for Goldmyne Entertainment Box Office as TV show presenter. She bin also work for radio station from 2012 until 2015.

For 2012, she produce di first season of her TV show, The Lounge wit Jumoke, one entertainment show wey feature celebrity interviews and fashion opinions.

She bin act oda movies wey include Arugba, Industreet, Gone, among odas.

Nollywood actors such as Mary Njoku, Rita Edochie, Wunmi Toriola, Jide Awobona, among odas don express sadness to di tori of her death.

Her death dey come as di Nollywood industry still dey mourn di death of Mr Ibu, Amaechi Muonagor and Sisi Quadri.

Nollywood actress Funke Akindele react to di death of Jumoke Aderounmu

Wia dis foto come from, Funke Akindele/Instastory

Acor Jide Awobona react to Jumoke Aderounmu death

Wia dis foto come from, Jide Awobona/Instastory