Nigeria go face Tunisia and Algeria for Group B of di Women African cup of Nations tournament wey go happun for 2025

Wia dis foto come from, Getty Images
Di draws for di Women African cup of Nations don happun and countries don know who dem go face for di first round of di tournament wey go happun for 2025.
Di Super Falcons of Nigeria dey Group B along with North Africans Tunisia and Algeria as well as Botswana.
Hosts nation Morocco dey headline Group A along with Zambia, Senegal and DR Congo.
While Group C get defending champions South Africa as well as Ghana, Mali and Tanzania.
Di 12-team tournament go end on July 26, 2025.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Nigeria wey host di first edition for 1998, don win di title nine times, followed by Equatorial Guinea wey don win am two times and South Africa wey win di last edition.
Di draws go take place for di Technic Centre of the Mohamed VI Football Complex in Sale, outside Rabat, Morocco.
All di four top-placed teams for di last edition dey among di teams wey qualify for dis edition. Dem include cup holders South Africa, hosts Morocco, Zambia and Nigeria.
Women Africa Cup of Nations Group
Group A: Morocco, Zambia, Senegal and DR Congo.
Group B: Nigeria, Tunisia, Algeria and Botswana.
Group C: South Africa, Ghana, Mali and Tanzania.
Meet di Draw Assistants
Andile Dlamini (South Africa): She be one of di key member of South Africa victorious 2022 Wafcon squad, Andile Dlamini na one of Africa most accomplished goalkeepers.
Many know her for her commanding presence and inspirational leadership, she bin play key role to helping South Africa claim dia first Wafcon title.
Salima Mukansanga (Rwanda): Na ogbonge referee, Mukansanga make history as di first female official to referee di men Fifa World Cup match during Qatar 2022. Her inclusion show her influence for African and global football, wia she don officiate plenty high-profile matches.
Fatiha Laassiri (Morocco): She be former Moroccan international and a celebrated figure for women football, Laassiri bin represent Morocco for various international tournaments. Now, she be respected coach and mentor, she dey advocate for women football development for North Africa.
When Wafcon dey start
Di13th edition of di Caf Women Africa Cup of Nations go take place from July 5 to July 26, 2025, for Morocco.
South Africa na di defending champions and dem secure dia first continental title for Morocco two years ago.










