Pundits tip Ademola Lookman to win Caf footballer of di year award

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Gift Andrew
- Role, Reporter
- Reporting from, Akure, Ondo State
- Read am in 3 mins
Football pundits don tip Nigeria striker to win di Confederation of African Football Caf best player award for 2024.
Dis dey come as Caf release di final list of di top five players wey fit win di award on Monday.
Di list include Simon Adingra of Cote d’Ivoire / Brighton & Hove Albion, Serhou Guirassy of Guinea / Borussia Dortmund, Achraf Hakimi of Morocco / Paris Saint-Germain, Ademola Lookman of Nigeria / Atalanta and Ronwen Williams of South Africa / Mamelodi Sundowns.
Ademola Lookman wey dey play for Atalanta turn up 14th for di Ballon D'Or award wey happen for October and na im be di highest ranking African player for di list.
Di 2024 Caf award ceremony go hold on 16 December 2024 for Marrakech, Morocco.
Wetin pundits tok

Wia dis foto come from, Getty Images
Coach Okay Lawrence of FJ Football Academy, Akure, Ondo State, tell BBC Pidgin say Ademola Lookman deserve to win di award as im get di best season so far and score hattrick for UEFA Europa league finals.
“Wetin im do na wetin no player don do bifor to score hatrick for Uefa competition, I no tink even Ronaldo and Messi don ever score hattrick for any football tournament finals bifor” na so di coach tok.
E say Lookman na child of grace and di best tin wey go happun to Caf dis season na to give am di trophy.
E add say “Ademola Lookman don get fantastic year wey evri top player dey dream to get. E finish 14th for di Fifa best and no African dey ontop am”.
Sports journalist Segun Odunayo tell BBC Pidgin say na Ademola Lookman go win di award as e reach di Uefa Europa league finals, score hattrick and win di trophy.
Segun say “I tink im don get beta season pass di odas for di list. E reach finals of Afcon finals and score some of di number of goals for di competition”.
According to am, Lookman play three finals and win one, and di trophy wey im win dey more important pass dat of di odas for di list in world football.
Names of players and coaches for di oda categories

Wia dis foto come from, Getty Images
Goalkeepers
Nigeria and Chippa United goalkeeper Stanley Nwabali and South Africa / Mamelodi Sundowns keeper Ronwen Williams dey meet again to contest who go win CAF best goalkeeper.
Odas for di list na Andre Onana of Cameroon/ Manchester United, Yahia Fofana of Côte d'Ivoire / Angers SCO and Mostafa Shobeir of Egypt / Al Ahly.
Interclub player of di year
- Issoufou Dayo (Burkina Faso / RS Berkane)
- Ahmed Sayed ‘Zizo’ (Egypt / Zamalek)
- Hussein El Shahat (Egypt / Al Ahly)
- Mostafa Shobeir (Egypt / Al Ahly)
- Ronwen Wlliams (South Africa / Mamelodi Sundowns
Coach of di year
- Pedro Goncalves (Angola)
- Emerse Fae (Cote d’Ivoire)
- Sebastien Desabre (DR Congo)
- Marcel Koller (Al Ahly)
- Hugo Broos (South Africa)
Young player of di year
- Karim Konate (Cote d’Ivoire / Salzburg)
- Oumar Diakite (Cote d’Ivoire / Reims)
- Yankuba Minteh (Gambia / Brighton & Hove Albion)
- Eliesse Ben Seghir (Morocco / AS Monaco)
- Lamine Camara (Senegal / AS Monaco)
Club of di year
- Al Ahly (Egypt)
- Zamalek (Egypt)
- RS Berkane (Morocco)
- Mamelodi Sundowns (South Africa)
- Esperance Sportive de Tunis (Tunisia).
Country of di year
- Cote d’ivoire
- DR Congo
- Nigeria
- South Africa
- Sudan









