Afcon 2025 qualified teams

Record title holders, Egypt

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Record title holders, Egypt don win all dia qualifying matches
Read am in 7 mins

So far, 21 teams don qualify for di 2025 African cup of nations for Morocco.

24 teams go take part for di tournament next year, di next round of qualifying matches dey happun now for November.

Equatorial Guinea, Ivory Coast, Senegal, DR Congo, Algeria, Egypt, Angola, Cameroon, Uganda and host Morocco na part of di kontris wey don book dia place for di ogbonge competition afta important wins for match day four

48 national teams across di continent dey take part for dis qualifying campaign.

Confederation of African Football divide di teams into 12 groups, for a series of matches.

Only di top two teams for di 11 groups wey no involve tournament hosts Morocco, go qualify for di competition.

Di 2025 Afcon dey scheduled to begin on December 21, 2025, and end for January 18, 2026.

Check out all di teams wey don book dia place for Afcon 2025.

Benin Republic

Benin Republic don secure dia place for di 2025 Africa Cup of Nations afta dem draw 0 - 0 wit Libya on Monday night.

Rwanda wey dey dia Group D bin beat Nigeria 2-1 but dat no reach to stop Benin Republic to qualify.

Benin Republic struggle to win two matches and finish wit eight points behind Nigeria wit 11 points.

Rwanda and Benin Republic bin share same eight points but dem progress wit goal difference.

Sudan

Sudan play a 0-0 goalless draw wit Angola but luck shine for dem for Group F afta Niger wire Ghana wit 2-1 for Accra.

Di Sudanese team bin secure dia place for di 2025 Africa Cup of Nations wit 8 points just behind Angola.

Ghana na di team wey no win any match for di group but Sudan win two of dia matches while dem draw two matches.

Algeria

Algeria secure dia place for di 2025 Africa Cup of Nations wit a 1-0 win ova Togo on Monday night.

Di win seal dia fourth consecutive victory for Group E of di qualifiers.

Dis result put di Desert Foxes on 12 points wit two games to go, and confirm dia qualification for di tournament for Morocco.

E go be Algeria seventh straight Afcon appearance and dia 21st overall.

Mathematically, na only Equatorial Guinea fit challenge Algeria top spot for di group, e mean say di Desert Foxes dey guaranteed of one of di two slots from di group.

Angola

A goal for di opening minute by Zini for dia match with Niger bin dey enough to secure Angola place for di tournament.

Angola, wey now don make am to four straight wins, dey top group F comfortably.

Sudan, Ghana and Chad na di oda teams wey dey battle for di second position.

Di gap between Angola and Sudan na five points wit two games to go.

Egypt

Record title holders, Egypt maintain dia winning run wit a 1-0 win ova Mauritania, na Ibrahim Adel score di winning goal of di match.

Di win stretch Egypt lead to 12 points for group C wey get Botswana, Cape Verde and Mauritania.

E seal di qualification to di 2025 tournament for di North Africans wey now don win four out of four of dia qualifying fixtures.

Senegal

Senegal leave am late to secure a 1-0 victory ova Malawi, courtesy of a stoppage-time free-kick from Sadio Mane wey help dem grab dia ticket for di tournament.

Di victory carry di Teranga lions to 10 points for group L wey get Burkina Faso, Burundi and Malawi.

Dem dey second for dia group wey Burkina Faso dey di top on goal difference.

Wit two games to go, Burundi and Malawi no go fit qualify again sake of di points wey dem get.

Malawi get zero points while Burundi get one.

Burkina Faso

Burkina Faso seal dia qualification to Afcon 2025 wit a 2-0 victory ova Burundi.

Mohamed Konaté score di first goal inside five minutes wit fine header from Cédric Badolo cross from corner.

Despite Burundi efforts to find equalizer, Burkina Faso maintain control of di game.

Di final blow come for 94th minute wen Bertrand Traoré score penalty, to seal dia win afta Trésor Mossi foul on Issa Kaboré.

Dat result send di Stallions to di top of Group L wit 10 point and guarantee a top- two finish for di West Africans.

Morocco

Morocco continue dia fine form for Afcon qualifiers, dem flog Central African Republic 4-0 for di Stade Honoré, Oujda.

Elias Ben Seghir score two times in quick succession for di 34th and 37th minutes, followed by a penalty conversion from Youssef En-Nesyri for di 50th minute.

Abdessamad Ezzalzouli score di last goal for di 65th minute.

Morocco, already don qualify for di tournament as hosts, dem extend dia perfect record for group B wit12 points from four matches, while di Central African Republic dey third wit three points.

Cameroon

Five-time Afcon winners Cameroon pickup dia tickets for di 24-team tournament for North Africa wit victory ova Kenya on Monday.

Boris Enow give Cameroon a 1-0 win for neutral ground for Kampala.

DR Congo

DR Congo perfect run continue for match day four of di qualifiers

DR Congo seal dia spot for di tournament wit 2-0 victory against Tanzania.

Meschack Elia score twice late on for di match to give di visitors di win.

Ivory Coast

Defending champions Ivory Coast don qualify for next year competition for Morocco.

Ivory Coast secure dia place afta Chad and Sierra Leone group G match end for 1-1 draw for di Stade Olympique Alassane Ouattara for Abidjan on Wednesday night.

Di result mean say third-placed Leone Stars no go fit overtake di title holders.

Wit nine points at di top of di group, di Elephants dey guaranteed at least di second position for di group as Sierra Leone, wit just one match remaining, dey four points behind di current group leaders.

Equatorial Guinea

Equatorial Guinea qualify for di 2025 Africa Cup of Nations even bifor dem play dia match.

Dem qualify afta Togo lose dia Group E qualifying match on Wednesday.

Di Sparrowhawks bin need to take all three points from dia trip to Liberia wey don already chop elimination to get small hope of reaching di finals for Morocco.

But, di Lone Stars lose 1-0 for Monrovia as Mohammed Sangare score di winner from di penalty spot for 83rd minute.

Togo go dey absent for a fourth successive Nations Cup, dia last appearance na for di 2017 tournament for Gabon.

Meanwhile, Equatorial Guinea dey guaranteed top-two finish for Group E regardless of di outcome of dia final two matches, dem go play at home against already-qualified Algeria on Thursday.

Nigeria

Three-time continental champions Nigeria dey among di kontris wey qualify on Thursday wit one match to go.

Victor Osimhen score for Super Eagles wey come from behind to draw 1-1.

Libya 1-0 win for Rwanda earlier in di day seal Nigeria top-two finish for Group D bifor even dia away game against Benin bin kick off.

As tins be now, Benin, Rwanda and Libya go all go into di final group matches wit a chance of reaching di tournament for Morocco.

Tunisia

Ten-man Tunisia score a 93rd-minute winner to win 3-2 away to Madagascar and book dia record-extending 17th successive appearance for di finals.

Tunisia dey top group A wit 10 points wey get Comoros, Gambia and Madagascar.

Gabon

Gabon qualify without dem playing afta results for dia groups go dia way.

Lesotho win Central African Republic 1-0 for dia match.

Gabon dey second for group B behind Morocco wey get 12 points.

South Africa

Bafana Bafana book dia place for next year Afcon sake of di result of South Sudan and Congo-Brazzaville.

As tins be for group K, Uganda dey top while South Africa dey follow dem for back.

Congo-Brazzaville bin need three points from dia trip to South Sudan but dem finish di game wit 10 men and lose 3-2 for Juba.

Uganda

Uganda, go return back to di finals for di first time since 2019.

Dem qualify for di tournament afta Congo-Brazzaville fail to pick all three points wen dem jam South Sudan.

South Sudan win dat game 3-2 for Juba.

Zambia

Zambia seal dia qualification for next year tournament wit a shock 1-0 victory ova di reigning champions Ivory coast.

Di victory see dem climb to top group G although di Elephants bin don already qualify bifor dem play di game.

Di result also end Sierra Leone hopes of qualification.

Mali

Kamory Doumbia first-half goal gIve Mali a 1-0 win for Mozambique, dem play di game for Maputo even wit di street protests sake of last month presidential election.

Di Eagles dey guaranteed a top spot for Group I, while Mozambique must avoid defeat against Guinea-Bissau for di final game to join dem for di finals for Morocco.

Zimbabwe

Zimbabwe bin know say a point from dia home game against Kenya go dey enough to secure a top-two spot for Group J.

Dem play 1-1 draw against di Harambee Stars to confam say dem qualify wit Cameroon for di group.

Comoros

Comoros go return to Afcon afta Myziane Maolida 90th-minute winner give dem a 2-1 victory away against Di Gambia and eliminate di Scorpions for Group A.

Di West Africans bin need at least a point to remain to give dem self hope and dem start well for di match.

Dem score first inside 18 minute through Alassana Jatta - but Rafiki Said quickly equalise for di islanders.

Comoros, wey bin reach di last 16 for dia debut for 2021 finals but miss out for di 2023 edition, dem go join Tunisia to qualify from Group A.