Kaizer Chiefs hold mourning prayer session for Luke Fleurs

Wia dis foto come from, Kaiser Chiefs
South African football club Kaizer Chiefs still dey mourn di death of one of dia player Luke Fleurs.
Di club hold one minute silence and prayer session for di Kaizer Chiefs Village on Thursday afternoon to remember di player.
Luke Fleurs die on Wednesday afta dem shoot am dead for one car hijacking situation, according to im team.
Di shooting happun for one petrol station on Wednesday night for Johannesburg suburb of Florida.
Di 24-year-old bin dey wait to buy fuel wen unknown gunmen approach am and order am to get out di vehicle.
One of di suspects run comot di scene wit Fleurs car afta di shooting.
Kaizer Chiefs, one of di most popular clubs for di kontri and 12-time league champions, describe im death as "tragic".
Di club say police dey handle di mata and dem go communicate further details in due course.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Kaizer Chiefs
Sports Minister Zizi Kodwa tok say im dey "saddened say yet anoda life don dey cut short sake of violent crime".
Defender Fleurs join Kaiser Chiefs last year. E previously play for SuperSport United.
E neva play for di senior national team yet, but report dey say im dey near im debut.
On dia website, Kaiser Chiefs describe Fleurs as "classy defender" wit "great technical abilities".
E start im career for 2013 for di Ubuntu Cape Town Academy, according to local media.
Di Premier Soccer League say one minute silence go dey observed for all top-flight and second-tier games dis weekend in memory of Fleurs.
"We wake up to di heart-breaking and devastating news of di passing of dis young life," South African Football Association president Danny Jordan tok for one statement.
"Dis na huge loss for im family, friends, im teammates and football in general."
Football fans don enta social media to mourn am.
"Di football family don lost a bright flame," soccer presenter Carol Tshabalala post on social media platform X.
South Africa dey grapple wit increasing gun violence, wit several mass shootings reported in recent years.
Di kontri get one of di world highest murder rates, according to police data.













