Dem don release Oscar Pistorius on parole for South Africa nearly 11 years afta im kill im girlfriend

Pistorius shoot Ms Steenkamp for 2013

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Pistorius shoot Ms Steenkamp for 2013

Dem don release ex-Paralympian, Oscar Pistorius on parole from one South African jail, nearly 11 years afta e murder im girlfriend Reeva Steenkamp.

E shoot her multiple times through one bathroom door for 2013, e later tok say im mistake her for tiff.

Dem convict Pistorius, wey be 37 years old now of murder for 2015 afta one appeal court bin reverse one earlier verdict of culpable homicide.

E go live under strict conditions until im sentence expire for 2029.

Under South African law, all offenders dey entitled to dey considered for parole once dem don serve half dia total sentence. Dem set Pistorius parole for 2017 at 13 years and five months.

Ms Steenkamp mama react to Pistorius parole

June Steenkamp

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, June Steenkamp, Reeva mama no dey against di parole application

Reeva Steenkamp mother, June Steenkamp, bin tok for one statement say: "We don always sabi say parole na part of di South African legal system, and we don always tok say di law gatz take its course."

"Oscar Pistorius release on parole, subject to certain conditions, don affirm Barry and my belief for di South African justice system," she tok, as she refer to her late husband.

"Di compulsory conditions by di parole board, wey include anger management courses and programs on gender-based violence, send out clear message say dem take gender based violence seriously."

"Justice don dey for Reeva?" she ask. "Oscar don serve enough time? Justice no fit eva dey if your loved one no eva dey come back, and no amount of time e serve for prison go bring Reeva back. We, who remain behind, na di ones wey dey serve life sentence."

She add say: "My only desire na say make dem allow me live my last years in peace wit my focus remaining on di Reeva Rebecca Steenkamp Foundation, to continue Reeva legacy."

Pistorius parole conditions

 Oscar Pistorius comot di North Gauteng High Court on June 14, 2016 for Pretoria, South Africa.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Oscar Pistorius various trials and hearings bin attract full media interest

Pistorius don dey prison since October 2014, wen dem first find am guilty.

Im lower legs bin dey amputated wen e never even reach one-year-old.

Pistorius bin later dey rely on prosthetics and e become world-renowned athlete known as di "blade runner".

E bin get successful career on di track, first for di Paralympics, e win multiple golds, and den e cement im reputation afta e compete against non-disabled athletes for di London Olympics for 2012.

Di murder of Ms Steenkamp just six months later, plus di subsequent trials, bin lead headlines around di world.

South Africa department of correctional services bin tok say despite im high public profile, dem go treat di former star like anyone else on parole.

Dis one mean say dem go restrict am to im house for certain hours of di day and e dey banned from drinking alcohol. E also no dey permitted to speak to di media.

Reeva Steenkamp - Pistorius girlfriend

Reeva Steenkamp for Johannesburg, South Africa

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Friends say Reeva Steenkamp dey kind-hearted and ambitious

Ms Steenkamp, wey be 29-year-old wen she die, be law graduate and successful model wey also bin dey work as TV presenter. She bin appear for one reality show dem call Tropika Island of Treasure.

She bin dey plan to start law firm to help abused women afta she graduate.

Ms Steenkamp bin dey three months into her relationship wit Pistorius wen e shoot her wit gun through di door of one toilet cubicle for im house for Pretoria for di early hours of 14 February 2013.

She die almost immediately.

Di state bin charge Pistorius wit murder but dem convict am for 2014 for lesser offence of culpable homicide, or manslaughter.

Di following year, judges for di Supreme Court of Appeal change im conviction to murder, dem tok say im version of events bin dey inconsistent and doubtful and say e bin "fire” di gun witout having a rational or genuine fear say im life bin dey for danger".