Court set date to free Oscar Pistorius afta almost 11 years in jail

Wia dis foto come from, Getty Images
Oscar Pistorious go dey free from prison on parole almost 11 years afta im kill im babe Reeva Steenkamp.
Di former Paralympic champion bin shoot Steenkamp plenty times from bathroom door on Valentines Day for 2013 before e later claim say e bin tink say she be tiff.
Pistorius wey now be 37 bin dey sentenced to 13 years in prison by one South African court for 216.
Di parole board say dem go free am on di 5 January 2024.
Steenkamp mama no oppose di bail but she write letter give di parole say she dey reason weda dem don handle Pistorius "ogbonge anger issues" for prison.
She add say she go fit dey "worry for di safety of any woman" wey pass im side.
June Steenkamp bin no attend di parole hearing on Friday wey happun for Atteridgeville prison wey dey near Pretoria.
Earlier dis year, her husband and di papa of her late pikin Reeva, die and she say di strain of dis mata don do dem strong tin.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Department of Correctional Services, howeva tok inside statement say, e dey "classified as first time offender wit positive support system, Oscar Pistorius parole placement dey in line wit Section 73 of di Correctional Services Act."
Dis go e di second parole hearing for Pistorius in under one year.
Im first parole bid bin dey cancelled for March on top ruling say im neva complete im minimum detention period.
South Africa Constitutional court later call di ruling mistake, wey lead to di parole hearing wey happun on Friday.
Rise and fall of Oscar Pistorius

Wia dis foto come from, Getty Images
- August 2012: Run for di London Olympics and Paralympics, wia im win gold medal
- February 2013: Shoot im girlfriend Reeva Steenkamp
- March 2014: Court case start
- September 2014: Judge say Pistorius dey guilty for homicide
- October 2014: Pistorius start five-year prison punishment
- October 2015: Dem move am go house arrest
- December 2015: Appeal court change di court judgment to murder
- July 2016: Im chop six years in jail for murder
- November 2017: Dem increase im sentence to 13 years, five months













