Police charge mother and boyfriend of missing 6-year-old girl wit trafficking and kidnapping

Six-year-old Joslin Smith

Wia dis foto come from, Executive Mayor Andrè Truter/ Facebook

Wetin we call dis foto, Serious search dey go on for six-year-old Joslin Smith, wey miss on 19 February

Police don charge di mother of one six-year-old girl wey dey miss for South Africa since 19 February wit human trafficking and kidnapping.

Dem charge Kelly Smith wit her boyfriend, Jacquen Appollis, and two odas afta dia arrest.

Ms Smith daughter, Joslin, disappear from her house for Saldanha Bay, near Cape Town.

Di four accused pesins bin appear for court, but dem say make dem no plead for inside di case wey don grip South Africans.

Di prosecution allege say Ms Smith bin instruct Oga Appollis and anoda suspect Stefano van Rhyn, to sell Joslin to one traditional healer for 20,000 rand ($1,000; £835), di privately owned Citizen newspaper report.

Evri five hours, child dey miss for South Africa, but dem dey see most of dem.

Dem still neva see Joslin, despite di massive search operation wey involve di navy, drones and sniffer dogs.

On Saturday, investigators find one cloth wey blood stain for one open field for di area wia Joslin take disappear.

Dem keep Ms Smith and her co-accused for custody until 13 March, wen dem go show for court again. Di suspects say dem go apply for legal aid.

Di disappearance of dis six-year-old girl dey shake South Africa

On Monday, 300 naval officers join rescuers from Cape Town, one dog unit and drones for di desperate search.

Authorities dey question two men and two women ova di disappearance.

"We dey hope say as di investigation continue, we go sabi her whereabouts or wetin happun to her, "Brig Novela Potelwa, police tok-tok pesin for South Africa Western Cape province tok.

On Saturday, investigators see cloth wey get blood for one open field for di area wia Joslin take disappear on 19 February.

Community members bin search canals and pits for days afta di girl disappear.

Saldanha Bay Mayor, André Truter tok say pipo wey dey para dey raid pipo houses and dey harass neighbours in search of di child.

Police don offer 100,000 rand ($5,200; £4,100) reward to anyone wey get information on her whereabouts.

Her mama boyfriend, Jacquin Appollis, na im she bin dey wit wen she miss.

E no fit account for her whereabouts, police tok. E don deny involvement for her disappearance.

Joslin mama don before now tell local publication, The Daily Voice say she no dey give up hope.

"My motherly instincts dey tell me say my daughter still dey alive and for dis area. We go find her, I go use leg waka to find her. I go look evri place, I go do am by myself if I get to."

Some community members bin accuse di couple say dem get hand for dia daughter disappearance, accuse wey both of dem deny.

Authorities don move dem go safehouse for dia own safety.

Brig Potelwa tok say make di public no spread false information about Joslin disappearance or share recordings from di search operations.

"Dis fit negatively impact di investigation. Di primary focus of di coordinated efforts na to find Joslin or wetin happun to her."