Peru prime minister resign afta accuse say audio wia e dey toast babe leak for public

Wia dis foto come from, Reuters
Peru Prime Minister Alberto Otárola don resign on top accuse say im try to use im influence to help one woman get beta government contracts.
Di scandal escalate last week wen one Peruvian TV broadcaster play audio clips of wetin e tok be conversations between di two.
Oga Otárola wey be 57-year-old don deny any wrongdoing.
Dem don launch investigation into di allegations.
According to di Panorama programme, wey first play di clips for weekend, you fit hear di woman wey Oga Otárola dey follow tok, Yaziré Pinedo, wey be 25-year-old.
Reports say dem award Ms Pinedo two contracts for work for di defence ministry for 2023 wey give her a total of 53,000 sol ($14,000; £11,000).
Oga Otárola na Peru defence minister until di end of 2022, wen President Dina Boluarte take office and e dey promoted.
For di audio clips, dem hear as Oga Otárola dey declare im love for di woman and e ask her to send him her CV.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin e tok different from one statement e bin release, say na only once im meet Ms Pinedo for one meeting.
She tell Peruvian broadcaster Canal N on Tuesday say she bin get brief relationship wit di PM before now.
Both of dem tok say di audio recordings na from conversations for 2021 - before Oga Otárola become cabinet minister.
Nevertheless, President Boluarte bin ask am to return early from one official visit to Canada, and im resignation follow.
"Those wey always want to get me out of goment... just edit one audio wit di aim of tarnishing my image," Oga Otárola tok for im resignation speech.
Among those wey e accuse say dem dey part of di plot to disgrace am na former Prime Minister Martín Vizcarra, wey tok on social media say im "strongly reject" di "delusional accusations".
According to Peruvian law, all 18 members of Peru cabinet must follow Oga Otárola and hand in dia resignations - but di president get di choice to reselect dem again if she wish.
Peru goment no be stranger to shake-ups - Ms Boluarte don order several cabinet reshuffles since she take ova power as she attempt to control opposition to her leadership.













