Anant Ambani: Rihanna, Mark Zuckerberg and oda world influential pipo land India for tycoon son pre-wedding gala

Di Ambani family for di engagement of Radhika Merchant (third from left) and Anant Ambani (fourth from left) for January 2023

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Ambani family for di engagement of Radhika Merchant (third from left) and Anant Ambani (fourth from left) for January 2023

Some of di world most influential pipo land India Gujarat state to attend one ogbonge wedding wey di richest man for Asia dey do for im son.

Mark Zuckerberg, Rihanna and Bill Gates dey among di guests wey show for di pre-wedding gala wey di Reliance Industries chairman Mukesh Ambani do for im son.

Anant Ambani, 28, dey ready to marry Radhika Merchant for July.

Bollywood stars including Shah Rukh Khan and Amitabh Bachchan also dey di three-day event for Jamnagar city.

Mukesh Ambani, 66, na currently di number 10 richest man for world. Im worth $115bn, according to Forbes.

Reliance Industries, wey im papa bin start for 1966, na very very big company wey operate for orisirishi sectors wey include refining and retail to financial services and telecom.

Anant Ambani na di youngest of im three children. All di children dey for di board of Reliance Industries.

Di 28-year-old dey involved in Reliance energy business dem and im also dey di board of Reliance Foundation.

Dis extravagant pre-wedding event dey show di Ambani family record of hosting extravagant wedding parties.

For 2018, pop sensation Beyonce bin perform for Ambani daughter, Isha Ambani pre-wedding party dem wey dem do for Udaipur city.

Former US Secretaries of State Hillary Clinton and John Kerry bin dey di guests for event.

One Bloomberg report during dat time bin say some sources say di Isha wedding bin cost $100m – but “pesin wey close to di family,” deny am say di bill bin be around $15m.

Di current party be start early dis week wit one event wia di Ambani family serve food give local pipo for Jamnagar.

Anant Ambani and Radhika Merchant for di dinner wey dem organise for di local pipo
Wetin we call dis foto, Anant Ambani and Radhika Merchant for di dinner wey dem organise for di local pipo

Na about 1,200 guests dey attend di pre-wedding party, wey dey occur for di township of Jamnagar near Reliance main oil refinery.

Reuters report say di guest list include India billionaires Gautam Adani and Kumar Mangalam Birla.

Dem dey also expect Disney CEO Bob Iger to show for di party, dis dey come some days afta im company announce say dem don merge dia business for India wit Reliance.

Zuckerberg, wey dey on a busy Asia trip, reach Jamnagar on Thursday.

Bill Gates, wey bin land India some days before, bin post video of imsef dey drink tea from one local tea maker - e later go viral.

Odas wey show on Friday include cricketers Mahendra Singh Dhoni and Dwayne Bravo, and BP CEO Murray Auchincloss.

Oda guests wey dem dey expect for di Ambani event include BlackRock co-founder Larry Fink, Alphabet chief executive Sundar Pichai, former Canadian PM Stephen Harper, former Australian PM Kevin Rudd and Ivanka Trump.

Mark Zuckerberg and im wife Priscilla afta dem enta Jamnagar

Wia dis foto come from, ANI NEWS AGENCY

Wetin we call dis foto, Mark Zuckerberg and im wife Priscilla afta dem enta Jamnagar

"Di guest list be like e get more RSVPs from international companies heavy weight dan di weddings of Ambani two older children for 2018 and 2019, and dis dey show Reliance growing control and im role as di channel to take enta India economy for global tech, media and energy giants," Bloomberg write.

Among di entertainment wey dey ground na performances by Rihanna and illusionist David Blaine.

Guests also dey expected to visit one rescue centre for Jamnagar, wey dem say na home to more dan 2,000 animals.

According to one planning document wey Reuters see, di dress code for dis visit na "jungle fever".