Highlights from Moses Bliss wedding from Nigeria to Ghana

Wia dis foto come from, Screengrab/Instagram/@mosesbliss
Popular Nigerian gospel singer, Moses Bliss, marry im wife Marie Wiseborn for ogbonge wedding ceremony wey start with di court wedding for Abuja, Nigeria and end with di church wedding on Saturday for Accra, Ghana.
Di couple wear colourful traditional Ghanaian cloth for traditional wedding and a simple but beautifully styled white wedding gown for di wife Marie while Moses - di husband - wear one off-white suit for di church wedding.
Part of di stand-out with di bride for di wedding na her simple, natural and conservative style. Marie style her natural hair for all di wedding ceremonies to match her choice of simple but elegant dresses she wear throughout with just a hint of make-up sometimes wey look almost natural.
Many Nigerians bin express dia joy wit di couple on top social media as di bride papa hand am ova to her husband and give di husband key to dia house for United Kingdom to show dia acceptance into di family.
Di bride Marie na from Ghana while Moses na Nigerian.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Some celebrities wey show for di wedding event for Acccra, na Nigeria Gospel singers Nathaniel Bassey, Tim Godfrey, Tope Alabi, and oda celebrities like Veekee James, Mercy Chinwo, Enioluwa Adeoluwa, Warri Pikin, Juliet Ibrahim among odas celebrate wit di couple
Many fans and celebrities bin don begin celebrate with di couple for social media as dem celebrate dia court wedding for Abuja, Nigeria.
Moses Bliss marriage post wey announce im court wedding bin don get ova 400,000 likes for im official Instagram page as at di time of dis report .
End of Di one wey oda users dey read well well
For di post, Moses Bliss say ‘’I dey legally married to my personal gift from God’’
‘’Lord we dey grateful for your help’’. Moses Bliss add put.
Di gospel singer share pictures of di court marriage wey take place for Abuja, Nigeria.
Dia marriage happun few weeks afta di gospel singer post video wia e propose to Marie on January 19.
Di singer bin post di full proposal for Im social media handle, di video show di moment wen im dey wait for arrival for one church for London.
And e capture di romantic moment wen im sing song wey im write for her as she waka enta di church.
Di couple meet for social media afta she tag am for video wey she bin dey dance to im song Miracle No Dey Tire Jesus.
Moses Bliss say na afta dat video dia relationship start.
E say "I was like ahh, 'I like di way she dey praise God, wow she dey dance like David,"
Di couple neva tok wen dia traditional and church marriage go take place.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Moses Bliss profile
Moses Bliss Uyoh Enang, aka Moses Bliss, na gospel singer, worship leader and songwriter.
Di gospel singer come from Akwa Ibom state, wey dey for di southern part of Nigeria.
For January 2017, Bliss release im first single wey im title "E No Dey Fall My Hand"
Two years afta im release di single "Too Faithful". Dat song get 64 million views on Youtube.
Na Moses Bliss be di founder of Spotlite Nation, a Nigerian record label wey dey manage artist likes Ebuka songs and a few odas for di gospel industry.
Im wife, Marie come from Ghana and recently she celebrate her call to bar for United Kingdom wia im surprise her to attend di event.

Wia dis foto come from, Instagram/screengrab@mosesbliss












