Family, friends and fans gada as South Africa music star Zahara make her final journey home

Wia dis foto come from, Getty Images
Di funeral service of Zahara, wey her real name na Bulelwa Mkutukana don happun for East London International Convention Centre as family and friends gada to celebrate her life.
Her friends and relatives attend di funeral service afta her body arrive for Phumlani, East London in the Eastern Cape Saturday morning for di burial.
Mourners wey attend di funeral wear black attire attend di ceremony while some attendees express dia frustration say dem don fail Zahara despite say she give di world great music.
Pipo dey cry, dey shed tears and show emotions as di funeral service dey hold.
Some musician also gada sing music during di burial to show say dem don lose one of dia colleague
On Friday, di family announce di funeral service of Zahara on her social media page as dem describe am as a music icon.
Zahara die on December 11, 2023. She bin dey 36 year-old wen she die of hospital afta short sickness..
During di funeral, president of South African Music Industry Council (SAMIC), Vusi Leeuw, describe Zahara as “blossoming flower”, say im come di funeral come pay m last respect to di deceased becos Zahara death na big lost for di Africa music industry.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Leeuw tok say she bin dey use her God given gift to di fullest wen she bin dey alive as her songs play ogbonge role in social coalition of di South Africa pipo.
Im tok say Zahara 2011 album “Loliwe” bin save di South Africa music industry as she record di highest sales afta Brenda Fassie “Vulindlela” 1997.
“Zahara Loliwe album do dat wit her ground breaking sales afta she break Brenda Fassie Vulendila album sales.”
Di president of SAMIC advocate for im members as im explain say di music industry na di mirror wey dey reflect for di society becos di capitalist approach of di industry dey work against dem as Africans.
Oga Leeuw thank di pipo wey gada to mourn Zahara death as im appeal to di President, Cyril Ramaphosa and im cabinet members make dem look into di copyright law so artists no go dey experience exploitation.
Im tok say pipo dey use social media to expoit di great talents for di South Africa industry and make goment increase di years wey dem fit reproduce artists songs to 80 years.
Also, Co-founder of TS Records, Thembinkosi Nciza wey discover Zahara for 2010 tok say she make history wit her 2011 album.
Thembinkosi Nciza wey pipo sabi as "TK Nciza" tok say Zahara heal pipo wit her music and inspire pipo wey come from her province.
Di record label owner tok say im bin believe say Zahara na im sister despite say dem get transactional issues.
“She dey proud of her background and wia she come from. She dey always say she must inspire many pipo wey come from Phumlani, and I tink she don do am,” im tok.
“She no be just musician to me, and I know say pipo dey always believe say na transactional issue. She be my younger sister, she be my kid, we love each oda till di last day."
Di pastor wey preach during di funeral service reference bible; Psalm 23 for im sermon as im compare di life of Zahara to David for bible.
Im tok say she fight battle and win like David becos im trust in God.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post













