Fast and Furious star Vin Diesel dey accused of sexual assault by im former assistant

Wia dis foto come from, Getty Images
American actor, Vin Diesel former assistant dey sue di Fast & Furious star of sexual assault as dem dey shoot di Fast Five feem for 2010.
Lawyer for di actor wey im name na Mark Sinclair say im client "deny di full claim, pata-pata".
Asta Jonasson tok inside di lawsuit say di actor bin block am for wall and den do sex act on imself.
She also dey sue for wrongful termination becos she say afta di attack im company sack am.
Ms Jonassin lawsuit wey dem file for Los Angeles on Thursday say di attack bin happun for Atlanta wen dem dey feem Fast Five.
She tok for di lawsuit say oga Sinclair, 56 bin overpower am for im hotel suite and "no gree hear Ms Jonasson clear statement of non-consent" and im grope am.
Di lawsuit say afta she "scream and run to enta one nearby bathroom", na im di feem star "use im bodi to gum am for wall" and touch imself.
"Just some hours" afta di attack, di lawsuit tok say di actor sister, Samantha Vincent, wey dey run im production company One Race Films, call Ms Jonasson and come fire am.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ms Vincent neva comot to ansa di claim.
Di suit allege say, "E dey clear to her say she bin dey fired becos she no longer dey useful - Vin Diesel use am to fulfil im sexual desires. She bin feel helpless, her self esteem scata, and she bin question her skills, or weda she go need trade her bodi to get successful career."
Di former assistant also claim say days before wetin happun wit di actor, anoda executive bin ask am for sex for di same hotel.
Togeda wit sexual battery, she dey sue for gender discrimination, illegal retaliation, emotional distress and wrongful termination.
'13 year old claim from nine day employee'
Bryan Freedman, lawyer for oga Sinclair tok for written statement give CNN say, "Vin Diesel deny dis whole claim."
E add say, "dis na di first time e don hear about dis 13 year old claim by an allegedly 9 day employee."
Lawyer for Ms Jonasson send statement give BBC News say her client, "wan hold Vin Diesel and di pipo wey allow and cover up im sexual assault accountable for dia terrible actions."
Di lawyer, Claire-Lise Kutlay say, "we hope her courageous decision to come out go create lasting change and empower oda survivors."
Vin Diesel dey known for oda movies apart from di Fast and Furious Franchise. E act for Guardians of di Galaxy, XXX, and Riddick.
E also be producer for di Fast & Furious series and na one of di actors wey de make money pass for Hollywod.















